Spain approve plan to give around 500,000 undocumented migrants legal status - how to dey eligible

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Guy Hedgecoe
- Reporting from, Madrid
- Read am in 2 mins
Spain govment don approve plans to carry legal status give 500,000 undocumented migrants. Dis go allow dem to enta formally inside di workforce.
Prime Minister Pedro Sánchez bin describe im govment decision as both "act of justice" and necessity for Spain.
For letter to Spaniards wey im post for social media, Sánchez wey be socialist tok say di mass legislation wan "acknowledge di reality of almost half a million pipo wey don alreadi be part of our evriday lives".
Spain conservative opposition People's Party (PP) don promise to try block di legislation wey dem tok say na reward for illegal migrants and go encourage one to come.
Di govment plan na to offer one year, renewable residence permit give undocumented migrants. To dey eligible, di applicants go need prove say e don reach five months wey e don alreadi spend for Spain and say e no get criminal record. Dem get from 16 April and di end of June to apply.
Sánchez tok say migrants bin help to "build di rich, open and diverse Spain wey we be and who we wan be".
Di prime minister tok say dis migrants dey needed to sustain di economy and public services for kontri wey dia pipo don dey old. E also tok say e be di right course of action for nation wey for di past don see many of dia own citizens sef wey japa for beta opportunities.
Di Funcas think-tank dey estimate say na about 840,000 undocumented migrants dey for Spain and most of dem na Latin American.
One Bolivian graphic designer, Ricardo wey no fit maintain stable employment and dey plan to apply for di scheme tok say, "Dis go benefit plenti pipo, give dem access to work and get beta life, And e mean more money for di Spanish state and more workers go dey legally available for employers."
Di opposition don tok say di government estimates dey wrong and add say na about one million migrants fit apply for di scheme, and PP describe di plan as "outrage".
Di Catholic Church, however, don support di govment legislation.
Di scheme dey come as many of Spain European neighbours dey tighten controls on immigration.
Both Socialist and PP govments don implement migrant amnesties bifor. Di last time e happun na for 2005 wia 577,000 pipo bin get residency for inside Socialist govment.










