Trump grant visa to mother of Ghanaian boy wey dem kpai for US

Trump wit blue suit and blue tie. Boy dey beside am dey smile
Published
Read am in 4 mins

President Donald Trump don agree to grant visa to di mother of Ghanaian boy Javits Frimpong, wey dem kill for Bronx, US.

Dis na for di mother to mourn her son in pesin, according to to di call between New York Mayor Zohran Mamdani and President Trump.

For post post on X, di New York mayor say di murder of child na pain no parent suppose to endure, ''let alone from thousands of miles away''.

''Javits Frimpong mother deserve to say goodbye to her son in pesin. I just comot di phone wit President Trump, and e don agree to grant her visa immediately,'' e say.

''All of New York City dey mourn dis tragedy, '' e add.

Dem shoot and kpai Thomas Frimpong 15-year-old son wen e bin dey go school on Thursday, 29 October 2026.

Police officers bin rush am to St Barnabas Hospital, wia e later kpai from im injuries.

Authorities dey search for three teenage suspects, wey dem believe to be between 16 and 18 years old, wey reportedly run comot from di scene wearing black clothing and blue surgical masks.

Police neva announce any arrest, while di motive for di shooting remain under investigation.

Di victim papa, Thomas Frimpong, believe say bullying wey im son allegedly experience for school fit dey connected to di killing.

Outrage and reactions ova killing of Javits Frimpong

Di mother of di murdered teenager, Doris Adu Gyamfi, wey dey live for Ghana second-largest city, Kumasi, dey expected for Accra on Monday to begin di visa process.

Large crowds don gada for di Bronx to mourn di death of di Ghanaian teenager.

Ghana govment on Friday condemn di killing and say e go explore all available measures to ensure justice.

''We go pursue justice and we go make sure say dose wey do dis no get away wit am." Ghana foreign ministry say for statement.

E urge US authorities to conduct thorough investigation and say e dey ready to provide legal and consular support to ensure di perpetrators dey brought to justice.

Dem shoot di 15-year-old dead by unidentified assailants for Bronx on Thursday morning.

Im papa say dem shoot am near dia home at about 09:20 while on im way to school. Di motive neva dey clear.

Investigators dey searching for three teenage suspects wey run from di scene. Surveillance images appear to show di teenager running for im life while dem dey chase am, one of di assailants wear all-black outfit and mask.

Im father, Thomas Frimpong, say di principal of im school don tell am bifor say dem dey bully im son and e lead to di suspension of two pupils.

E no dey clear weda dat one dey linked to im death.

Ghana Foreign Affairs Minister Samuel Okudzeto Ablakwa say di govment don express dia condolences to di family.

''Ghana remain steadfast for dia commitment to di safety, dignity and well-being of our citizens evriwia, any time, and for all circumstances," e add.

Di shooting happun for Claremont, near Crotona Park, an area wit large Ghanaian community for Bronx.

Ghana foreign ministry say officials from dia mission for New York don visit di family.

No arrests made yet, as di New York Police Department dey ask anyone wit information to contact Crime Stoppers.