Iran choose to discuss wit Oman instead of US afta Trump comment about di Strait of Hormuz
- Author, Bernd Debusmann Jr
- Role, White House reporter
- Reporting from, Air Force One
- Author, James Chater
- Published
- Read am in 5 mins
Iran say dem dey negotiate wit Oman to reach "understanding" ova one temporary route through di Strait of Hormuz to allow commercial shipping to resume.
Di statement dey come afta US President Donald Trump announce say new talks on ending di war for Iran go start on Monday - and add say im don call off "massive" strikes on di kontri for dis purpose.
Trump no make am clear who go take part for di toks. Earlier, e say dem don agree on di "perimeters" of one deal – wey go include reopening Hormuz, di vital waterway wey di closure by Iran don make oil price continue to rise.
For dia response, Iran say dem no dey negotiate wit US – and dem no get plans to do so.
Tok-tok pesin to di foreign ministry Esmaeil Baghaei add say Tehran dey negotiate wit Oman to reach "one understanding on top path to ensure di security of shipping passage through di Strait of Hormuz".
Tehran don repeatedly close off di strait since US and Israel start attacks on di kontri for February.
Talks to end di conflict – wey mediators mostly arrange – bin collapse last month, wey put an end to one ceasefire dem agree on for April.
Trump don repeatedly vow say negotiated end to di war dey close, only for tit-for-tat strikes to resume.
On board Air Force One on Sunday, Trump tok say Iran "sabi di extent" of di planned US strikes "becos dem see wetin dey come", e add say: "We dey follow dem tok for di form of a negotiation. E go start tomorrow afternoon."
Trump no gree give deadline for for di deal dem go strike deal wit Tehran, e add: "We go see how e be. We ready to go anytime we want... I no dey reason to kill pipo."
Trump tok say Saudi Arabia Crown Prince Mohammed Bin Salman - plus US partners like United Arab Emirates and Qatar - bin beg am make im no carry out di strikes for weekend.
"We bin don set to go," Trump tok. "Di reason dem ask be say dem tink say dem don get deal," na so im tok. "Get deal for Hormuz, and e go get deal for nuclear too."
Global oil price fall for Monday morning during Asia trading afta Trump announcement. Brent Crude oil drop by 4.5% go $83.98 (£62.26), while US-traded oil drop by 4.6% go $80.74 (£59.85).
Energy price don dey up and down since di war start on 28 February as traders dey react to wahala wey dey shipping through Strait of Hormuz.
Around 20% of di world crude oil and liquefied natural gas (LNG) dey pass through di strait evri time.
Iran semi-official Mehr news agency deny say Tehran ask US to hold off further military action. Dem say Trump claims na "notin but new lie".
For Sunday, Iran Foreign Minister Abbas Araghchi tok say negotiations wit Oman on deal about Strait of Hormuz "dey on track to finish", according to Iran media.
Di US president neva tok wia di tok-tok go hold for Monday, or who go attend.
While im dey tok for Air Force One, Trump say di planned strikes for don be "di biggest attack since World War II", and e for spoil chance to end di months-long war wit negotiation.
Trump refuse to answer if e bin don dey plan to strike Iranian energy infrastructure, wey international law experts don tok say fit constitute war crime.
Iran acting Defence Minister Majid Ibn al-Reza tok earlier say Tehran dey see evri threat from dia enemies as "real and credible" even if na psychological warfare.
"We no go allow dem catch us unaware and we no go just dey quiet," e add.

US president don dey give Tehran apocalyptic warnings bifor, only for am to later tok say dem dey give diplomacy chance.
For im post on Saturday, im tok say US "dey locked and loaded and ready to go against di Islamic Republic of Iran, for Military Terror, Strength, and Power level wey nobodi don see since World War II".
But im add say dem cancel di attack "for di future benefit of di world and, same way, for di survival of successful and prosperous Iran".
For 7 April, di US president warn say "whole civilization go die tonight" if Iran no gree enta peace toks. For dat time too, im threaten say im go destroy civilian infrastructure and power plants.
Dat threat lead to historic face-to-face tok-tok for Pakistan, wey Vice-President JD Vance lead. But dose negotiations no go anywia.
Trump administration don also dey dismiss data wey show say di war - and di economic impact - no dey popular wit Americans at all, including many Republicans.
Polls wey show say pipo no dey happy wit how dem dey handle di war don cause alarm for some conservative strategists wey dey reason di November midterms wey dey come.
With additional reporting from Peter Hoskins.











