Who be di victims of Kempton Park murders for South Africa as authorities discova fifth bodi

Wia dis foto come from, South Africa Police Service
Police for South Africa don discova di deadi bodi of anoda woman for Kempton Park area, Gauteng.
Di bodi of 38-year-old jogger Elizabeth "Tsontso" Moselakgomo wey police announce on Monday, 14 September go make am di fifth bodi dem go discova for Kempton Park, especially for Rhodesfield area for Gauteng, in di past two months.
Her disappearance bin spark nationwide call as kontri pipo beg for help in finding her.
Acting National Commissioner of di South African Police Service (SAPS), Lieutenant General Puleng Dimpane, tok say preliminary investigation wey detectives gada show say di circumstances wey surround di five deaths dey similar.
E say di women dey half-naked wit visible bruises and for di same area.
"Dem find di bodis of di women half-naked and wit visible bruising, and di discovery sites dey located within di same vicinity."
Oga Dimpane don rule out di possibility say di deaths dey linked to serial killer, even though investigation still dey go on.
Who be di victims?

Wia dis foto come from, SA Justice, Crime Prevention and Security
Di first victim na one 37-year-old woman wey authorities discova her bodi near R21 on 15 July.
Police neva confam her identity yet, but dem say dem find her naked and e be like say she bin dey restrained wit cable ties.
Justice, Crime Prevention and Security say dem don arrest one suspect and e dey for custody.
"For dis case, our investigators don already make progress, and one suspect currently dey for custody. Dem arrest di suspect on 17 July 2026. Di investigation into dis mata dey continue."
On 24 August, authorities discova di second bodi, one 32-year-old woman, near di R21. Dem also find her partially clothed.
Di third bodi na dat of one unidentified woman wey dem discova on 10 September 2026.
Police say di bodi bin dey advanced state of decomposition and dem find her naked. "At dis stage, we neva fit formally establish her identity. Di identification process dey go on," police tok.
Di fourth bodi na dat of one 38-year-old woman wey dem discova on 12 September for Rhodesfield for di back of one hotel for di area.
Di woman bin dey wear sports clothing and dem find her partially clothed.
Her identity still dey subject to formal confirmation by di family through di mortuary identification process, authorities tok.
Di fifth bodi na dat of 38-year-old Elizabeth "Tsontso" Moselakgomo. Police say her family identify her on Monday for di Germiston mortuary.
Moselakgomo bin go missing afta one afternoon run on 9 September for Rhodesfield, Kempton Park.
Her disappearance bin raise concerns for di area, as authorities bin put out resources to search for her.
Wetin authorities dey do?
Di police don arrest one pesin in connection wit di discovery of di first bodi for July, and e still dey for custody.
Meanwhile, di police don set up one task team to investigate di murders but dis grim discoveries and Moselakgomo death don spark renewed outrage and fear among South Africans.
Di Acting National Commissioner of di police don order di team to investigate dis cases and determine weda di incidents dey related.
Di task team go include detectives from specialised units, wey include di Murder and Robbery Unit, di Investigative Psychology Unit, plus oda relevant disciplines and resources required to urgently advance di investigation.
Gauteng Deputy Provincial Commissioner, Major General Mbuso Khumalo go lead di team, wey im work na to find di pesin wey dey responsible for dis deaths.
However, police say preliminary information show say di circumstances wey surround di deaths dey similar.
"While investigations still dey go on, SAPS for dis stage neva confam say di deaths dey linked to serial killer, police dey veri concerned about di similarities and e reach for dem to issue public warning and intensify investigations," di police tok for statement.
Police don also ask women for Kempton Park area to avoid walking or running alone "particularly for isolated areas".
Dem also advise women to avoid places wey pipo no too dey, remain vigilant and, if possible, travel or exercise in groups.
South Africans react to di deaths of di women
Tributes don dey pour in for di avid runner wey pipo sabi well well as "Tsontso" afta police confam her death.
South Africans also share di fear and anxiety women often dey feel for di kontri.
One jogger wey sabi Moselakgomo through dia running club tell BBC say di discovery of di five bodis dey "veri scary".
"E dey sad to know say evri woman for South Africa… no fit just go outside. You no fit just enta shop and buy flowers… becos you always dey for danger," Keamo Sefularo tok.
Sefularo say Moselakgomo disappearance dey "heavy for di club".
Di 29-year-old also ask weda Moselakgomo go "still dey hia if maybe she bin get one small community to run wit [or] one or three pipo"?
"As we always say, wen we go out for runs, safety dey in numbers," she tok.
Lesedi Ledwaba, for one post on X, say: "Women no dey free if we gatz calculate wia, wen and wit whom we fit walk, run or exist safely".
Advocacy group Women for Change say di discovery of dis bodis dey make dem vex.
"Wetin be di purpose of having a protective service like di police if we gatz make sure… we dey [protect] oursefs," Merlize Jogiat from di group ask.
Jogiat mostly blame poor implementation of laws wey dem pass for di failure to curb di issue and she say "pressure in numbers" from citizens fit be di solution.
Moselakgomo family don tank di public for di support in searching for di mama of dia daughter wey leave behind one pikin. Dem also hail her eight-year-old daughter for raising di alarm about her disappearance.









