South Africa arrest more foreign nationals afta dem deport 90 thousand undocumented migrants

Wia dis foto come from, Ihsaan Haffejee/Anadolu via Getty Images
South Africa don reveal say di number of undocumented foreign nationals wey dey don deport so far na almost 90,000.
Di kontri announce say dem don begin put more efforts into how dem go secure dia border and stop foreign nationals wey no get documents to enta.
According to South Africa, dem say dis large number of foreign nationals wey dem deport through repatriations na dose wey no get di right and legal documents to stay for dia kontri.
Na South Africa Minister of Justice and Constitutional Development Mmamoloko Kubayi tok dis one for im media briefing wia e add say dem don make progress for how dem go take handle immigration matter.
"Between 14 June and 20 August 2026, some 86 596 foreign nationals dey processed for deportation and repatriation through coordinated law enforcement operations," di minister say.
Dis repatriation process na sake of di various kasala wey anti immigration protests don cause for di kontri, afta some group begin hala say make undocumented immigrants comot for South Africa.
In recent times, anti immigrants protests don take different turn afta some groups begin attack foreigners wit sticks and oda items.
Na part of dis immigration wahala make kontris like Nigeria, Ghana, Malawi and odas begin dey carry dia citizens comot back to dia home kontri.
South Africa na Malawi get di highest number of citizens wey dem don send back to dia kontri while Zimbabwe and Mozambique follow.
According to dia data, dem say "90 per cent of repatriated foreigners enta di kontri illegally, wit 95 percent classified as border jumpers."
Dem say di Temporary Repatriation Processing Centre wey dey for Musina wey dem open to keep foreigners wey dem wan deport don shut down as dem no get plenti foreigners wey dey queue for deportation
SA govment say dem go kontinue to work wit neighbouring kontri and regional ones so dem go fit address undocumented migration.
More dan 4000 foreigners arrested for border
South Africa also reveal say dem arrest ova 4000 foreign nationals wey try enta dia kontri witout documents.
Dem say na for border dem gbab dem during operations wey exposed di illegal foreigners.
"More dan 4 200 undocumented foreign nationals chop arrest afta dem attempt to enta South Africa outside formal ports of entry between April and July 2026."
Dem add say most of dose wey chop arrest na along di northern corridor border of Zimbabwe, followed by border areas around Lesotho and Mozambique.
"South Africa get extensive land borderline of approximately 4471km, wey dem share wit six neighbouring kontris."
"Dis don negatively affect border safeguarding operations and creating vulnerability wey dey cause exploitation of illegal crossing, smuggling and transnational crime."
South Africa say dem don arrest more foreign nationals for going against di immigration act by staying in di kontri witout legal documents.
"Seven suspects dey arrested for sake of say dem dey di kontri witout di required documentation, against di Immigration Act, " South Africa police tok.









