Wetin be norovirus wey make ova 100 passengers fall sick for Caribbean cruise ship?

Read am in 5 mins

More dan 100 pipo don fall sick for one cruise ship wey dey come from Fort Lauderdale, Florida, wit highly contagious norovirus during dia two-week trip.

Di Center for Disease Control confam di outbreak of norovirus on Thursday wia dem announce say 102 passengers and 13 crew members don fall sick and dem don isolate dem.

Di Caribbean Princess ship get more dan 4,000 pipo onboard, as e depart from Port Everglades to di Caribbean on April 28 to May 11, for di 11-day trip, according to Cruise Mapper.

In quick response to di outbreak, di crew don increase cleaning, dem don disinfect di ship and isolate pipo wey don fall sick.

Dem don also collect poo-poo sample from pipo wey get gastrointestinal illness for testing, di CDC tok.

Norovirus na leading cause of acute gastroenteritis worldwide. Some of di Symptoms include diarrhoea and vomiting, according to di World Health Organization.

Cruise ships, wit crowded spaces and new environments for travellers, fit become hotspots for illness.

Dis infections dey spread quickly just like di case of Hantavirus, wey break out last week, wey cause di death of three pipo.

Dis no be di first time norovirus go break out. For 2020, ova 300 passengers for one cruise ship bin fall sick of norovirus, and during di 2024 German festival e affect ova 800 pipo.

Symptoms of norovirus

Norovirus symptoms include nausea, vomiting and diarrhoea but wit high temperature, abdominal pain and bodi ache too dey common.

E dey quick spread, wen you come in contact wit pesin wey get am or wen you chop food wey pesin wey get am cook.

Pipo wey don dey infected wit norovirus also fit experience dehydration, especially among small pikin and vulnerable groups wey get weak immune system.

Most healthy pipo go recover within few days, but e fit cause serious problem for vulnerable groups.

"You fit still pass di virus to anoda pesin within di days afta you fall sick," Amy Douglas, one epidemiologist for UK Health Security Agency tok.

"E dey really important say if you dey experience diarrhoea and vomiting, make you take steps to avoid passing di infection to anoda pesin" Ms Douglas tok.

Ms Douglas tok say pipo wey get di symptoms make dem isolate demsefs until 48 hours afta di symptoms don end, and make dem no cook food for anoda pesin make e chop during dat time.

"Dis one na becos you fit still pass di virus afta you don stop to dey sick."

UKHSA advise say make pipo dey wash dia hands regularly wit warm water and soap to avoid passing on norovirus.

Dem also ensure say dem wash dia any surface clean wit bleach-based wey go fit help di stop virus from spreading.

"Alcohol no dey kill norovirus, so no rely on am alone," Ms Douglas tok.

To limit di spread of norovirus, CDC advise passengers make dem wash dia hands frequently, rest well and drink enough water.

Passengers dey encouraged to go any medical center once dem see say dem don dey feel sick.

How to prevent contacting norovirus

You fit find norovirus for your vomit or poo-poo even bifor you start to dey feel sick.

Di virus fit also stay for your poo-poo for two weeks or more afta you don feel beta. You fit still spread norovirus during dat time.

Dis na tips from CDC on how you fit prevent norovirus:

Norovirus dey veri contagious, but you fit take steps make e no spread.

Wash hands well wit soap and water under running water; hand sanitizer alone no go fit work well against norovirus.

No handle food, cook am or care for oda pipo wen you dey sick

Bifor you chop any food, carefully wash di fruits and vegetables well-well.

Cook on temperature of at least 145°F, becos norovirus resistant to heat and e fit still survive high temperature as high as 145°F.

Quick steaming processes or microwave no go fit heat foods enough to kill noroviruses becos food wey dey contaminated wit norovirus dey look, smell, or taste normal.

Clean and sanitise your kitchen utensils, cutting boards, counters, and surfaces, especially afta you don cook.

Clean and disinfect any surfaces for inside house.

Throw away food wey fit contain norovirus.

How dem dey treat norovirus?

Most pipo wey get norovirus go recover within 1 to 3 days. No special medicine dey to treat pipo wey get norovirus.

Antibiotic drugs no go fit help treat norovirus infection becos e dey fight bacteria, no be viruses.

Drink plenti water to dehydrate your bodi, you go fit replace di fluid wey you lose from vomiting and diarrhea.

Sports drinks and oda drinks witout caffeine or alcohol fit help wit mild dehydration.

However, dis drinks fit no replace important nutrients and minerals. Oral rehydration fluids wey you fit get ova di counter na di most helpful for mild dehydration.

Seek medical care make - e no go lead to serious problem.