Ghana fashion icon Nana Akua Addo husband deny allegations of abuse afta trending videos

Wia dis foto come from, NANA AKUA ADDO
Ghana actress and fashion icon Nana Akua Addo bin dey trend for social media on Tuesday afta videos of wetin look like kasala wit her husband surface on line.
Di 42-year-old mama of two, allegedly end up for hospital afta fight wit her husband.
Inside one of di videos, di actress bin dey sit for wetin resemble hospital bed wia her dress get wetin be like plenty blood stains, also di same stains for di floor.
For anoda video, Nana Akua and her husband bin dey exchange words for wetin dem describe as family meeting.
Di man bin dey drag her sake of im claim say she be unfaithful, na so Nana Akua also accuse her husband say im too dey unfaithful.
Her husband and im brother also continue to dey exchange words wit her for di presence of one of dia daughters and at least two oda adult relatives.
For di third video wey also bin go viral, her husband appear to hit her eldest daughter, na so Nana Akua Addo begin dey shout "you want kill my pikin give me, di same way you dey slap me, you don slap Jesusa my pickin."
She continue as she tok say: "Kill my pikin give me, dis place don turn war zone, you dey beat me, dey beat my pikins too."
Pipo on top social media bin dey tag di Ghana police service to chook eye for dis mata as di videos and pictures dey trend online.
Close friends and followers dey ask di security agencies to enta di case bifor tins go become late.
Dem alleged say di fashionista bin dey suffer abuse for her marriage for many years but she bin dey protect her public image and brand.
Nana Akua Addo bin respond to one blogger wia share di video of her pickin when her husband bin dey abuse her.
"I beg make you take di video down sake of my child, I beg."
Some of her fellow industry colleagues bin dey offer her words of encouragement.
Musician Sista Afia bin write "I genuinely dey admire you, to dey watch wetin you dey go through don touch me deeply. I understand dis kind of pain sake of I don pass thru bifor, I sabi di emotional weight."
"I don dey pray say God go give you strength and courage to rediscover yourserf. You deserve peace, love and so much more," di musician add.
One of her fellow actresses Ama K Abebrese write say "I dey pray for strength for you and your children."

Wia dis foto come from, NANA AKUA ADDO
Nana Akua im lawyers warn against sharing abuse video of her daughter
Lawyers for di actress and media personality for one statement address di public about di video wey dey show abuse of her daughter at di hands of her papa.
"We don see many harrowing videos of our client and her children for one domestic kasala wey bin dey trend on top social media, dis videos leak without di knowledge and consent of our client,"Fafa Fianu bin tok.
Her lawyers add say "Dis leak na deep violation of her privacy and di privacy of di children wey be minors."
"We don dey ask say make media houses no publish di videos espcially di ones wey involve di minors."
Lawyer Fafa Fianu further explain say "dis na delicate mata wey involve children, we gatz protect di mental wellbeing of di victims of dis unfortunate mata wey already bin dey deal wit plenty trauma."
"Dis mata currently dey for di hand of di appropriate authorities for di kontri, we dey grateful for di timely response of di Ghana Police, we get confidence for our court system to stand up against domestic violence for our society."
Dem add say "for di appropriate time, our client go address all di kasala, for di mean time, we don dey ask di media and di public to respect di privacy of di family as dem deal wit dis situation."
Lawyers for Nana Akua 'husband' react to di tori
Inside one statement from lawyers for Nana Akua im husband, dem share dia side of di tori.
According to di statement wia Emmanuel Bright Atokoh don sign, di videos of di injuries and oda tins wey bin dey trend, na "sponsored online circulation to control di public narrative and get public sympathy against di facts of di mata wia be subject bifor di police."
Dem add say "di mata dey for di police domestic violence and victim support unit (Dovvsu) and civil case wia Nana Akua don file for court."
Di lawyers bin explain how some of di injuries wey Nana Akua don allegedly get, bin happun.
According to di statement, Nana Akua Addo allegedly attack her estranged husband wen im return late from one programme for 2021, na so "she bin accuse am of infidelity wia she try to use knife to stab am."
"Dat be di third time she don stab her husband for dia marriage wia she don scata items for di house and injure pipo. Our client don report most of dis cases of violence to di police for Spintex, East Legon and Nmai Dzorn"
Dem add say dia client don "withdraw all di criminal complaint afta Nana Akua family and friends bin beg to protect her public image as star and for di sake of di pikins."
Lawyers for Harold Norman further explain say Nana Akua injure her lips one day wen she bin dey try to stab her husband wia im use dressing mirror to block di knife.
"Di knife now hit di mirror wia di mirror scata, na so some of di glass bin splash and chook her mouth, e neva dey true say na our client don assault im wife wey lead to di injury wey don dey online."
According to dem, her husband na di pesin wey bin rush her to hospital sef afta dat mata but "she bin record di tin wey she don release am five years afta di incident for public sympathy now wey di two parties bin dey court."
Dis na sponsored campaign to cover up wetin di lawyers describe as "long years of abuse wia Harold Norman, dia pikin and oda family members bin suffer for di hand of Nana Akua for di 14-year marriage."

Wia dis foto come from, NANA AKUA ADDO
Profile of Nana Akua Addo
Di 42-year-old former beauty queen na actress and fashion model.
She bin make name for herself as di fashion goddess for Ghana and Africa wit her statement outfits for di annual Africa Magic Viewer's Choice Awards (AMVCA).
Every year, Nana Akua bin dey steal di red-carpet wit her exquisite style and costume.
She bin feature for more than 10 movies wia she don produce at least two odas.
Her red-carpet fashion culture begin afta she bin win best dressed personality for one movie awards event for 2016.
Dat be when di German-born actress discova say she fit take dis fashion tin go far.
Every year since dat time, she bin dey invest plenty money for her red-carpet looks wey don give her di name she don get around Africa.
Now she don add fashion styling to her portfolio; she bin dey style oda celebrities and personalities.
Nana Akua Addo don work wit many Ghanaian, Nigerian designers, wey she don work wit international brands too.
Beyond her stunning red-carpet and fashion job, Nana Akua dey married to Harold Norman wey she be mama wit two daughters.
Last month, Nana Akua Addo bin turn heads for di Milan Fashion Week wit her bold costume wia bin celebrate African heritage and legacy.
She wear one ogbonge dress wia dem use 'Ghana must go' material to sew am.


















