'I win di 2023 election' - Peter Obi

Peter Obi look inside camera dey smile. E wear black cloth, eyeglass and get small grey hair for head
Wetin we call dis foto, Peter Obi na di presiddential candiate for di Nigeria Democratic Congress (NDC)
Published
Read am in 3 mins

Di Presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC) Peter Obi don tok about wetin happun for di 2023 presidential election.

Di former Anambra State govnor for exclusive interview wit di BBC tok say even though im no like to dey go back to di past, im still stand on wetin im tok say na im win di election and evritin no be about evidence.

"I no like to dey go back to di past, I still stand on wetin I tok. Evidence no dey, no be evritin dey based on evidence. I win di election" im tok.

About stepping down for consensus candidate among all di opposition parties if dem no choose am as di flag bearer im say opposition parties need to dey find more voters.

"For di last election, even for Sokoto dem get ova two million registered voters. Opposition suppose dey tok about how we fit get additional 25 million pipo to come vote as im tok say "We no need to step down we need to do di right tin.

For 2023 Presidential Election Tribunal Peter Obi bin challenge di outcome of di election but court say e no win.

'Corruption na di problem of subsidy'

Di issue of fuel subsidy dey cause tok-tok since di time wey president Bola Tinubu remove am on inauguration day.

Di Action Democratic Congress (ADC) presidential candidate Atiku Abubakar say im go bring am back if im win di 2027 election and Peter Obi say fuel subsidy no bad but na di corruption wey join am make am bad.

"From day one I bin tok about subsidy, I tok about di corruption, di corruption na di problem of di subsidy."

Peter agree say if dem elect am as president im go bring back fuel subsidy but terms and conditions go apply.

"Yes, rememba say I qualify am, but no be wit di corruption wey follow am."

"I go remove di corruption and retain di subsidy."

'I go dey in charge'

Corruption na one of di issues wey Nigeri dey battle wit ova di years. Differnet administrations dey promise to reduce am well-well but di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) still dey invest and arrest poliricians weyndeon serve for previous admininstrations for questioning.

To tackle corruption for Nigeria, Peter Obi tok say families fit reduces corruption for di kontri by 50 percent.

"If you no dey tiff, if you no dey involve, your wife and your family no dey involve you don reduce corruption by 50 percent.

On di issue of fighting corruption for Nigeria, wen BBC ask Peter Obi wetin im go do differently from former president Muhammadu Buhari wey bin promise to fight corruption but yet pipo under im govment still tiff plenti money wey land dem for di EFCC hand, Obi tok say President Muhammadu Buhari "bin no dey incharge. Di difference be say I go dey incharge."