All di big moves for final day of 2026 summer transfer window

Wia dis foto come from, Getty Images
Di 2026 football summer transfer window for di English Premier League go close by 23:00 BST dis Tuesday, dat na 11:00 PM Nigeria time.
Normally, na two transfer windows dey for evri football season. Di winter window dey usually be for January while di summer window dey start for mid or late June to di first day of September.
According to Fifa rules, transfer window no fit last more dan 16 weeks for one calendar year, and dis summer transfer window bin open on Monday, 15 June 2026.
Di transfer windows for Spain, France and Italy go also close dis Tuesday, but dia time go be earlier for evening, while di one for di German Bundesliga go also close by 7:00 PM on Tuesday.
Di 2026 summer transfer window for di EPL dey certain to break all di records of di total amount wey clubs spend to sign new players or wey dem earn from selling dia players to oda clubs.
Here na some of di big transfers wey clubs dey look to finalise on dis deadline day.
Barcola to Liverpool - Alan to Man City

Wia dis foto come from, Liverpool FC/Liverpool FC via Getty Images
France forward Bradley Barcola don complete a £123m transfer from Paris St-Germain to Liverpool on a five-year deal.
Dis deal dey expected to be di most expensive business transaction for dis transfer window.
Di 23-year old winger come to try to step into di big boots of Egyptian winger Mohammed Salah wey comot from Liverpool for di end of last season.
"Na great pride say I dey able to play for Liverpool. I dey veri happy. E bin take long time but I happy today say I go dey play for Liverpool and all I want now na to be on di pitch and play," Barcola tok.
Also, for di blue side of di city of Manchester, Man City don sign 22-year-old Brazilian winger Allan, on five-year contract wey worth up to £34.2m.
Di right-side winger na direct replacement for im compatriot Savio - formerly known as Savinho - wey comot from Man City to join Tottenham.
Allan score nine goals and provide 12 assists in 96 appearances for im club Palmeiras afta e grow from dia youth system.
"To be able to sit here today and say I don join Manchester City, na di proudest moment of my life. We dey follow di team well-well for Brazil bicos of di beautiful football wey Manchester City dey play," Allan tok.
Grealish to Everton - Ndiaye to Man City

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester City Jack Grealish fit return to Everton for anoda one year loan, while talented Everton midfielder Iliman Ndiaye don conclude im move to Man City on a permanent deal.
Grealish bin also spend last season on loan to Everton but e return to Man City for di beginning of dis season and even play one match for di citizens so far dis season.
For di oda hand, Manchester City don agree deal worth up to £65m to sign Iliman Ndiaye from Everton.
Tottenham bin first agree terms wit Everton for Ndiaye, but di agreement be say dia Brazilian striker Richarlison go move to Everton for a separate transfer.
However, sabi pipo tok say Richarlison no agree personal terms wit Everton so Tottenham no fit proceed wit Ndiaye transfer.
Mudryk, Tosin to Tottenham - Sanchez to Como

Wia dis foto come from, Getty Images
Chelsea don accept offers from Tottenham for winger and defender Tosin Adarabioyo, while dia goalkeeper Robert Sanchez go also move to Italian club Como on loan.
E dey expected say di three players go comot from Stamford Bridge once dem agree personal terms.
Mudryk neva play competitive match since November 2024 sake of say dem ban am on top accuse say e take illegal drug, but dat ban don finish since July.
Tottenham coach Roberto de Zerbi sabi Mudryk wen e coach am for Ukraine club Shakhtar Donetsk. Di deal worth £61m for di forward player wey Chelsea bin sign for 2023 for £89m.
Tottenham go also sign Chelsea defender Adarabioyo on permanent deal to replace dia centre back Kevin Danso, wey don join Sunderland on loan.
Meanwhile, out-of-favour Chelsea goalkeeper, Robert Sanchez go move to Italy club Como, on one-year loan deal, wia e go join im former teammate Trevoh Chalobah wey bin also join Como from Chelsea £31m earlier for di transfer window.
Sanchez make two mistakes wey lead to goals for Chelsea first match of di season, na im coach Xabi Alonso run go buy Aston Villa World Cup winning goalkeeper Emiliano Martinez for £7.5m.
Balogun to Everton - Beto to Ipswich

Wia dis foto come from, Getty Images
Everton don also agree £40m deal wit Monaco of France, to sign dia Nigerian-American striker Folarin Balogun.
Balogun na one of di stars wey shine wella for di US national team during di 2026 Fifa World Cup. E don score 12 goals in 31 matches for di USA, and 31 goals for 91 matches for Monaco.
Everton bin wan sign dia former striker Richarlison wey dey now play for Tottenham, but tori be say di two parties no agree personal terms.
Meanwhile, tori be say Everton striker Beto fit move to Ipswich on loan as di arrival of Balogun fit mean say e no go get enuf playing time.
Enzo Fernandez to Man City?

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester City don start tok wit Chelsea to try to sign midfielder Enzo Fernandez.
If dis transfer happun, e go be di ogbonge deal of dis summer transfer window and e go also be one of di most expensive deals of di summer.
Tori be say Chelsea dey ask for minimum £120m for Fernandez and di two clubs dey currently go on to negotiate dat price.
Fernandez bin work wit City manager Enzo Maresca wen di Italian coach bin dey for Chelsea so both of dem dey eager to reunite again
Wetin remain now na weda di two clubs fit agree price to make di deal happun. If di clubs fit reach agreement, sabi pipo say to agree personal terms no go be issue.
Odas...

Wia dis foto come from, Getty Images
Newcastle and Juventus don reach verbal agreement to sign 24-year-old Germany forward Nick Woltemade on loan, witout option to buy.
One of di tallest players for di EPL, Woltemade also play for Germany for di 2026 World Cup wia dem disappoint and comot for di first knockout stage.
Hull City don also agree £22m deal to sign Nigerian-British midfielder, Tim Iroegbunam from Everton.
Iroegbunam bin join Everton from Aston Villa for £9m for 2024, and e dey expected to complete im medical bifor di transfer window go close.
Anoda Nigeria-British player, Ethan Nwaneri of Arsenal dey expected to complete im medical for Germany dis Tuesday for im loan move to Borussia Dortmund.
Nwaneri bin also spend last season on loan for Olympique Marseille of France.
And yet anoda Nigerian-British striker, Tammy Abraham go remain for Aston Villa as e reject loan move to Ipswich.
Di striker decide make e fight for im place for Villa Park afta di arrival of Nicolas Jackson for £65m.
Villa Boss Unai Emery tok say: "Now we get one striker, Jackson, we dey veri happy wit am. We also get Brian Madjo, but e get injury and Tammy Abraham don decide to stay hia.
"We bin open di door for am but e decide to stay hia wit us. I go dey veri demanding wit am to add im qualities wit us... E bin no perform like we want last year."










