Israel and Iran resume bombing afta two months cease fire

Part of bomb wey don already explode wey comeout from ground

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Part of di missile comeout from di ground for di West Bank wey Israel dey occupy sake of di earlier strikes from Iran
Published
Read am in 5 mins

Israel don bomb western and central Iran, afta Iran fire missiles go northern Israel.

Na di first time Iran and Israel dey launch attacks for each oda territory since di ceasefire bin start two months ago

Iran say dis attacks na "di beginning of a full week of continuous bombing"

Iran launch dia attacks afta Israel bin carryout air strikes on Beirut for Lebanon on Sunday.

Di Israeli military say dos strikes, wey Hezbollah target for di city southern suburbs, na response to Hezbollah wey fire rockets for Israel.

Donald Trump bin tell Israel make dem no attack Iran, im bin tok say im go call Benjamin Netanyahu "right now and tell am make im no retaliate".

According to di Israeli Defense Forces (IDF) dem "complete a large-scale strike" on "strategic defence systems" for Iran.

Inside new statement, dem tok say "dozens of Israeli Air Force fighter jets" bin dey involved for di attacks for central and western Iran, dem add say di systems bin dey dismantled.

"These strikes further enhance di Israeli Air Force freedom of action for Iranian air space," di IDF tok.

But Israel emergency service organisation don tok since say "no casualties dey known" at dis stage.

Foro of Benjamin Natanyahu as e dey tok for microphone, e wear black coat, blue tie and white inner shirt.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Benjamin Netanyahu, Israeli Prime Minister

Israel Prime Minister Netanyahu dey under growing pressure

Dis war don weaken di Iranian regime - na how Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu take describe Iran threat to Israel wey don dey exist since - but e neva lead to dia collapse.

In fact, di leadership be like say dem dey becom more confident and maybe more confrontational.

Di indications be say Netanyahu dey concerned about di potential deal between di US and Iran, dem consider am to be disadvantage for Israel, and many dey suspect say im dey try to create a situation for di war to resume.

Netanyahu dey under growing pressure at home.

Inside discontent wit Hezbollah continued attacks, support for di war for Lebanon dey to continue, even though e no dey clear wetin Israel attacks fit achieve to to bring down di group as President Trump don limit Israeli actions as im dey try so dat di kasala no go continue.

Finally, election for Israel don reach and e go happun bifor October, and di prime minister fit lose im job.

Oil prices don climb up

Pesin hand wey hold pipe wey dey put gas for inside car

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Di average price for petrol wey no get lead now na ova £1.58 a litre for di UK, according to di RAC

Oil prices don continue to climb afta Iran and Israel bomb each oda for di first time since dem bin agree on ceasefire between dem and di US for April.

Di price of di global benchmark Brent go up by 4.5% at $97.30 (£73) a barrel, while crude wey US-dey sell gain by 4.3% to around $94.50.

E dey too early to say weda na di strikes wey mark full escalation of di war, but traders don begin to price di risks to global oil markets, na wetin di Associate Professor Jiajia Yang from James Cook University for Australia tok.

Asian markets bin fell sharply on Monday, wit major indexes like South Korea Kospi wey fall by nearly 8%.

Meanwhile di Houthis - di Iran-backed militia for Yemen - say dem go ban all Israeli maritime navigation for di Red Sea, and any movement go dey considered as target for dem.

Di Houthis don continue to attack Israeli ships wey dey travel thru di Red Sea throughout di kasala.

For statement from spokesperson Yahya Sarea, di group also confam say dem bin attack Israel wit missiles.

Map
Wetin we call dis foto, Map wey dey show di areas wey Houthis dey control

Di latest development na anoda sign of how fragile di situation be for di region and e fit further complicate President Trump efforts to strike a deal wit Iran.

Dis war no be wetin pipo for US like, wia many still dey struggle to understand why e happun in di first place, while Iran closure of di Strait of Hormuz don lead to economic shock wey di world dey feel sake of dis war.

One of di obstacles for di negotiations for dis kasala na conflict from Lebanon, wia di Iranian-backed militia and political party Hezbollah dey base.

Di group bin start to attack Israel again afta di killing of di Iranian supreme leader wen di war bin start for Israel. Israel, bin respond, as dem bin carry out devastating bombing campaign, wey kill more dan 3,000 pipo including many civilians, and dem dey occupy a significant part of southern Lebanon.

Iran say di ceasefire for there include di kasala here, and dem bin don threaten to strike Israel if dem attack di southern suburbs of Beirut known as Dahieh, where Hezbollah dey base.

Israel reject say Lebanon na part of di truce, dem say war against Hezbollah go continue.

Di group dey reduce well-well for di kontri but dem don reject calls to disarm, sometin wey di Lebanese govment say dem go only achieve thru diplomacy, not war.