Wetin we know about arrest of content creator Odogwu Asaba over death of 21-year old woman

Foto of Content creator Odogwu Asaba

Wia dis foto come from, Odogwu-Asaba Instagram

Wetin we call dis foto, Foto of Content creator Odogwu Asaba
Published
Read am in 3 mins

Di death of one 21-year-old girl don lead to di arrest of popular content creator for Asaba, Delta State.

Di content creator Ifeanyi Ogbonna wey pipo sabi as Odogwu Asaba chop arrest on Tuesday, police confam.

According to di Delta State Police Command, dem arrest di suspect sake of allegation say e rape one girl wey dey 21 years.

For statement di Delta State Police Command say " Police don arrest Ifeanyi Ogbonna, male, wey dey 40 years, also dey popularly known as "Odogwu of Asaba," in connection wit di alleged rape of a 20-year-old woman, wey later die."

Polce say dem arrest am afta dem receive petition for di Command wey allege say on 1 June 2026, di girl bin travel go Asaba wen di suspect bin invite her.

"Im bin offer to train her in content creation, a programme wey im reportedly promote through im social media platform," Police tok for statement.

Tori be say di girl kpai hersef afta di incident as local media dey report say di suspect bin use style drag di girl wey kpai hersef go Asaba as im bin promise to help her.

Police tok-tok pesin for Delta State, SP Bright Edafe, confam say true-true dem arrest di content creator.

Tori be say na on Tuesday police arrest am for im house afta one human right activist Comrade Israel Joe write petition against am.

Local media dey report say di suspect wey dey chill wit police don confess say im commit di crime.

Odogwu Asaba or im representative neva tok anything. Meanwhile, video wey dey spread on social media show di content creator inside handcuff dey tok about di incident.

Wetin e dey tok for di video no clear. Di girl mother and her twin sister also dey di video.

How e take happun?

For di statement, Police explain say "wen she bin land for Asaba, di suspect allegedly carry her go hotel wia im allegedly raped her and subject her to physical violence. She later return home visibly distressed and tell her parents about di incident.

"Afta di alleged assault, di deceased bin do video recording wia she bin tok about her experience and di emotional distress wey she bin suffer sake of di incident. She subsequently kpai hersef by afta she take toxic substance and later died despite efforts to save her life." Police explain.

Tori be say di Commissioner of Police, Delta State Command, CP Yemi Oyeniyi, direct di Area Command Effurun to carry out immediate and thorough investigation into the allegations.

Operatives of di Command begin chook eye for di mata sharp-sharp, na di investigation wey leading to di arrest of Ifeanyi Ogbonna, also known as "Odogwu of Asaba."

During di preliminary investigation, di suspect bin make useful statements to di Police, as investigation still dey go on to establish di full circumstances wey dey surrounding di case.

Wein go happun next neva clear. Weda dem go carry am go court or not.