Wetin Kenya authorities dey do to stop di spread of Ebola afta one confirmed death

Health worker dey check im Personal Protective Equipment (PPE) during training by medical charity. E wear yellow and white coverall wit blue gloves and google for eyes.
Wetin we call dis foto, Kenya govment say dem don prepare since for Ebola and dem dey do evritin to stop din spread.
Published
Read am in 4 mins

Kenya President William Ruto don order di National Security Council Committee to assess Kenya Ebola situation and recommend further measures .

Dis dey come afta di kontri record and confam dia first Ebola case wey one Kenya citizen carry enta di kontri, di pesin don die sake of di virus.

Di patient wey be Kenya bin travelled from di Democratic Republic of Congo through Uganda and e test positive for Ebola Bundibugyo virus.

Even though authorities neva report any new cases so far, authorities say na 27 passengers from di Kampala-Nairobi flight dem don dey trace or contact.

Eight family members and 21 healthcare workers dey under quarantine and dem go monitor dem for 21 days.

Wetin Kenyan authorities dey do stop di spread?

Di East Africa kontri don tighten dia public health security afta dem confam say one man kpai sake of di kontri first Ebola case.

Officials don step up surveillance for airports and oda border posts sake of di death of di man.

Di man bin dey live for DR Congo bifor e fly into Kenya for weekend from Uganda.

Kenya ministry of health maintain say dia alert for Ebola dey veri high since di outbreak start for May 2026.

According to one publication for dia website, dem tok say as at 6 October, dem don screen over 6,000 pipo wey dey travel.

"Health authorities bin screen 652,584 travellers and test 267 samples across five laboratories: di National Virology Reference Laboratory, Kenya Medical Research Institute laboratories for Nairobi and Kisumu, and mobile laboratories for di Busia and Lwakhakha border points. One sample test positive.

Di Ministry also tok say dem don prepare well-well as di total number of health workers for national and sub-national levels wey don receive training na almost 5,000.

"Total of 4,971 health workers for di national and sub-national levels don receive training for Ebola prevention and management."

Authorities outline steps to prevent Ebola

Kenya authorities encourage pipo to do di following to prevent di spread of Ebola:

Make dem wash dia hands evritime or make dem use use alcohol-based hand rubs to sanitise dia hands.

Avoid close contact wit sick pipo wey dey come from kontris wey dey report active Ebola transmission.

Make dem seek care for any recognised health facility if dem dey feel unwell.

Make Members of di public should also report anyone wey dey unwell to di nearest health facility.

Health workers too gatz dey vigilant and need to apply infection prevention and control measures evritime.

More dan 8,000 pipo don dey infected and more dan 4,000 pipo don died sakemof di disease since May.

Unicef say na 1,900 children don die and dem don lose one or both caregivers to di virus.

Static map

Wetin be di Bundibugyo strain of Ebola Virus

Bundibugyo virus disease (BVD) na severe and form of Ebola disease wey fit kpai pesin sharp-sharp.

Na di Bundibugyo virus, wey be one of di Orthoebolavirus species dey cause am.

Na zoonotic disease wey dey associated wit fruit bats wey dem suspect say na di natural reservoir.

Human infection dey occurs through close contact wit di blood or secretions of infected wildlife like bats or non-human primates.

E deyb later spread from pesin to pesin through direct contact wit blood, secretions, organs, or oda bodily fluids of infected individuals or contaminated surfaces.

E deyb transfer well-well for health-care settings wen infection prevention and control (IPC) measures no dey adequate, and during unsafe burial practices involving direct contact wit pipo wey don die wey carry di decease.

Di incubation period na from 2 to 21 days, and individuals dey usually infect pipo until dem start to show symptom.

Early symptoms no dey specific as e include fever, fatigue, muscle pain, headache, and sore throat wey be symptoms of some oda common illness too.