Iran say dem target American base afta fresh US strikes

A US fighter jet takes off.

Wia dis foto come from, US Navy via Getty Images

Wetin we call dis foto, Di strikes come for di middle of fragile ceasefire and protracted negotiations to end di war, wey start wen US and Israel strike Iran on 28 Feb
    • Author, Nardine Saad
    • Author, Alys Davies
  • Published
  • Read am in 5 mins

Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) say dem don target American air base in di region, afta US carry out fresh on southern Iran.

IRGC no tok wia di base dey, but Kuwait, wey dey host one US base, say dem don catch "hostile missile and drone threats", and dem no mention wia dem dey come from.

Earlier, US military tok say dem shoot down Iranian drones ova di Strait of Hormuz and strike one military site for Bandar Abbas, wey be strategic port city.

Di renewed hostilities dey threaten di ceasefire wey don already dey fragile between America and Iran.

Dis na di second time in three days wey di US don attack targets for Iran - dem say di strikes na in self defence.

US Central Command (Centcom) say dem strike di site for Bandar as e dey about to launch a fifth drone, Iranian media report say dem hear explosions for di east of di city.

Centcom describe dia actions as "measured, purely defensive, and intended to maintain di ceasefire".

Dem also say dia forces shoot down four Iranian one-way attack drones "wey pose threat around di Strait of Hormuz".

Iran don condemn di strikes as "a grave violation of di ceasefire" and vow say di Iranian govment "no go leave any act of hostility unanswered.

Iranian foreign ministry spokesman Esmail Baqai wey condemn di action add say di Islamic republic go "take all necessary measures to defend dia national sovereignty", according to quotes wey di IRIB cite.

A BBC map of the Strait of Hormuz region, showing the narrow strait between The Gulf to the west and the Gulf of Oman to the east. The north of the strait is the coast of Iran and the United Arab Emirates and Oman are to the south. Bandar Abbas is highlighted in red on the Iranian coast at the narrowest point of the strait. The map also labels Dubai and Abu Dhabi in the UAE on The Gulf coast. A small inset map shows the location of the region within the Middle East and between Africa and Asia.

Earlier dis week, US bin confirm one previous round of "self-defence" strikes on southern Iran on Monday wia dem target Iranian missile sites and boats wey dey try lay mines for di Strait, wia thousands of commercial tanker ships dey stranded sake of di conflict.

Centcom say dem design di strikes "to protect our troops from threats wey Iranian forces poses".

US don also impose sanctions on di "Persian Gulf Strait Authority" – di Iranian body wey dey tasked wit collecting payments from ships wey dey travel through di Strait of Hormuz.

Any ship wey dey pay di authority fit also dey "exposed to di risk of sanctions", US Treasury Department tok for statement.

One-fifth of di world liquefied natural gas and oil dey normally pass through di shipping channel, and dia closure don impact global fuel trade.

Iran foreign ministry tok-tok pesin Esmaeil Baqaei on Monday tok say Tehran dey collect money for "navigational services" and dem go continue to manage traffic through di waterway.

US Treasury Secretary Scott Bessent describe am as di "Iranian military latest attempt to extort global maritime trade" and "proof" say Iran dey "desperate for cash".

IRGC on Tuesday also say dem don shoot down one US drone and fire one fighter jet plus anoda drone wey enta Iranian airspace, but no tok wen.

Long negotiations don dey take place to end di three-month war wey don choke traffic for di Strait of Hormuz and cause global energy prices to shoot up.

During one cabinet meeting on Wednesday, US President Donald Trump say Iran dey "negotiate on fumes", as e insist say im war strategy no go dey impacted by November US midterm elections.

"Maybe we gatz go back and finish am, maybe we don't," e tok.

During dat meeting, di president also urge Gulf nations to sign on to di Abraham Accords to normalise relations wit Israel.

Israel launch di war against Iran alongside US on 28 February and also dey for war wit Iranian-backed Hezbollah for Lebanon.

Trump don threaten to resume large-scale bombing campaign if Iran no agree to im terms.

While Trump give optimistic note ova di weekend, e say peace deal wit Iran don dey "largely negotiated", but by Wednesday cabinet meeting, e say US "no dey satisfied".

E say Tehran dey ready to reach agreement to end di conflict, but add say "so far dem neva reach there", as e repeat Washington willingness to resume strikes if no agreement dey reached.

Im comment afta Iranian state TV report wetin dem say be details of a draft agreement, wey include reopening di Strait of Hormuz and di withdrawal of US forces from di region.

Di White House call di text a "complete fabrication".

Both sides say dem dey make progress towards a deal late last week, however, Tehran soon caution say deal no dey close, while Trump say im don order im negotiators "make dem no rush into" one.