Nigeria to repatriate 'last set of' citizens from South Africa - wat next

Nigerian passengers, wey dem repatriate from South Africa, come down from one chartered plane afta dem land for Murtala Muhammed international airport Lagos, Nigeria on June 11, 2026.

Wia dis foto come from, TOYIN ADEDOKUN / AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigerian passengers, wey dem repatriate from South Africa, come down from one chartered plane afta dem land for Murtala Muhammed international airport Lagos, Nigeria on June 11, 2026.
Published
Read am in 5 mins

Ova 300 Nigerians dey expected to leave Johannesburg on Wednesday, 15 July, as part of Nigeria govment repatriation exercise to evacuate dia nationals wey wan comot South Africa sake of di anti-immigration wahala for di kontri.

Nigeria ministry of foreign affairs say dis go be di "last and fifth" evacuation exercise under di voluntary govment repatriation programme, and di final flight wey go end di programme.

Di Air Peace aircraft wey go fly 315 returnees dey expected to depart South Africa by 1:30am and land Murtala Mohammed International Airport, Lagos by 6:30am, tok-tok pesin for di ministry Kimiebi Ebienfa tok.

However, di National Publicity Secretary of di Nigerian Union South Africa Akindele Olunloyo tell BBC News Pidgin say ova 100 Nigerians still dey ground wey wan comot South Africa.

"We still get sizeable number of Nigerians wey dey severe harm's way and desperate for repatriation sake of di ongoing xenophobic tensions for South Africa. Several Nigerian families wit small children dey squat and sleep outside di Nigerian embassy for Pretoria, by di side of di road for extremely deplorable conditions for dis bitingly cold season."

Di union call on di Nigeria and various state govments, plus well-meaning Nigerians, to please come to dia aid urgently

Nigeria High Commission for South Africa tok say na about 1,000 pipo bin register to dey repatriated wen di programme start for June.

One Nigerian man wey just land Nigeria from South Africa kneel down

Wia dis foto come from, NEMA/X

Plenti kontris, wey include Ghana, Nigeria, Uganda and Kenya begin fly dia citizens home in recent times, afta weeks of anti-immigration protests for South Africa wey don see violence, intimidation and looting.

Protesters dey demand tighter border controls and mass deportations, as dem accuse migrants say dem contribute to high unemployment, rising crime rates and collapse of public services.

Anti-migrant activists don threaten to stage weekly protests to pressure di govment until all undocumented migrants comot dia kontri, and fears dey say di protests fit turn violent.

Di protests don lead to diplomatic katakata between South Africa and some African govments.

Allegations say foreign nationals na im be di target of di attacks dey continue to dominate conversations but South Africa president bin deny dis claim.

Tori of pipo wey don kpai sake of di kasala dey too but South African authorities say dis claims no be true but pipo still dey call for independent investigation.

Meanwhile, di protest appear to dey yield positive result as di South African govment announce on Sunday say dem don deport or repatriate more dan 53,000 foreign nationals since dem launch di "migration management" campaign five weeks ago.

Justice and Constitutional Development Minister Mmamoloko Kubayi tok say di repatriation and deportation process don help dem catch pipo wey dey wanted by di police for alleged criminal activity.

Nigerian national carry boxes

Wia dis foto come from, Per-Anders Pettersson/Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigerian nationals dey wait to enta bus go OR Tambo International Airport afta dem process dem for di Nigerian High Commission on June 10, 2026 for Pretoria, South Africa

However, Nigeria govment don promise to support di returnees, as dem say dem go facilitate dia safe return, welfare and reintegration back to di Nigerian society.

Di National Emergency Management Agency (Nema) wey dey in charge of dis, say dem go collabo wit oda agencies to ensure say di returnees get di appropriate assistance and support bifor dem reunite wit dia families.

Part of di humanitarian support Nema dey provide na logistics arrangements to transport di returnees go dia respective states of origin, and security agencies to ensure safe movement of di buses wey carry dem from di airport.

Also, Nigeria govment don ask di returnees to document any business interests or property dem leave behind, as authorities dey consider possible compensation claims wit di South African govment.

Dem also ask dos wey dey affected sake of illegal migration related incidents to also report to di ministry.

Nigeria Senate give two-week deadline to probe alleged attacks on citizens in South Africa

Pipo gada to stage anti-immigrant protest against illegal migrants

Wia dis foto come from, Ihsaan Haffejee/Anadolu via Getty Images

Nigerian Senate don give dia Foreign Affairs Committee two weeks to investigate alleged attacks against Nigerians for South Africa and don recommend possible govment action.

Di move bin come afta lawmakers debate calls to nationalise South African companies wey dey operate for Nigeria and use dia assets to compensate Nigerians wey suffer losses during recent anti-migrant protests and attacks.

Di senate reject di proposal.

Deputy Senate President Barau Jibrin, wey bin preside ova dat plenary, bin ask lawmakers to wait for di committee findings bifor dem take further action.

"Let di committee on foreign affairs investigate first. Nigeria dey lead Africa. We need to lead by example. Once we get well-informed facts, we fit take action. If dis report no dey satisfactory to dis chamber, then we go follow wetin you dey tok," e tok.

Senate bin adopt four resolutions, wey include call for di Nigerian govment to seek written assurances from South Africa on di safety of Nigerians and push for di arrest and prosecution of dos responsible for attacks.

Dem also direct di Ministry of Foreign Affairs, di Nigerians in Diaspora Commission (Nidcom) and Nigeria High Commission for South Africa to document cases wey involve deaths, injuries, displacement, unlawful detention and property losses, wit view to seeking legal redress and compensation.