Nigerian military confam death of retired major general Rabe Abubakar for bandit hand

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI/AFP via Getty Images
Di Nigerian military don confam di death of Major General Rabe Abubakar rtd wey die for di hand of terrorist wey abduct am.
Di military make dis confamation on Saturday 13 June 2026, through dia Director of Defence Information , Major General Samaila Uba.
Dem say di retired major general lose im life wen e dey for captivity for di hand of di jaguda pipo wey kidnap am.
Report of di kidnap of major general Rabe come last month wen tori say jaguda pipo attack am for Katsina.
"Di Defence Headquarters regret to announce di passing of Major General Rabe Abubakar (Retired), wey tragically lost im life in captivity following im abduction,' di statement tok.
Di Defence headquarter say dem convey dia deepest sympathies to di 'Abubakar family, im colleagues and all Nigerians.'
According to di statement, Nigerian military say dem no publicly tok about di abduction of di retired officer wen e happun sake of say dem dey try rescue am safely.
"Di Defence Headquarters withheld public comment on im abduction sake of ongoing rescue efforts by di AFN and sister security agencies. Evri operational resource dey deployed wit di hope to secure im safe return."
End of You may also be interested in:
Na last month May 2026 tori of di abduction of di retired senior Nigerian military officer and im wife bin trend.
Di military confam to di BBC say dem receive di informate say Abubakar dey di hand of kidnappers.
Military tok tok pesin Gen Michael Onoja tell di BBC dat time say efforts dey under way to rescue di couple and track down dia captors.
Di death of Maj Gen Abubakar don reawake more insecurity concerns for Nigeria as several school children still dey di hand of terrorists, bandits and oda armed group.
Although, no group come out to say dem dey behind di abduction of di retired army officer,di military wait for kidnappers to contact di family, di army say.
Local reports say di retired general dey travel to Katsina for wedding wen gunmen attack im vehicle, and capture am.
According to report, major general Abubakar driver allegedly escape despite say e sustain gunfire, while di attackers carry di former military tok tok pesin and im wife enta forest.
"Dis sad loss further strengthen di resolve of di AFN. We go remain resolute for di discharge of our constitutional mandate to defend di sovereignty and territorial integrity of Nigeria and to protect all citizens," di defence headquarters tok.
Dem say sake of di series of unfortunate abductions across Nigeria including dat of Maj Gen Abubakar, dem don begin ongoing operations to 'bring perpetrators to justice and to dismantle all terrorist networks wey dey threaten our nation.'
"E die natural death" - Katsina govment react to death of general Abubakar
Meanwhile, di Katsina State Govment, also confam di passing of retired Major General Abubakar.
Katsina govment say na inside bandits captivity e die, despite di efforts wey dem make to rescue and secure im release.
"Di deceased Retired General die natural death from complications of diabetes and hypertension."
"Im abduction and subsequent death no be only loss to im family and Katsina State but monumental loss to di entire kontri.
Govnor of Katsina State Malam Dikko Umaru Radda, extend im deepest condolences to di family of di late General and di country at-large.
According to Katsina Commissioner Internal Security and Home Affairs, na dark moments for di state but dem go kontinue dey press against di "criminal elements wey dey threaten di peace of our communities."
Who be major general Rabe Abubakar
Maj Gen Rabe Abubakar na retired senior Nigerian military officer wey serve for di army and hold big positions.
Oga Rabe na former military tok tok pesin between 2015 and 2017.
Nigeria Army say retired major general Rabe serve di nation wit distinction and hold many appointments including tok tok pesin of various military formations.
E also serve as well as tok tok for di Armed Forces of Nigeria wia e hold di post of Director Defence Information.
Dem say e make good contributions to counter-insurgency operations, professional development of di military amongst oda impacts.
Oga Abubakar na from Batsari Local Govment Area of Katsina State, north-west, Nigeria.
Dem commission am into di Nigeria army as second lieutenant for 1989.
E become defense tok tok pesin for August, 2015 afta e take ova from Major General Chris Olukolade.










