Ecuador intelligence chief, im wife and five Americans die for Kenya helicopter crash

Wia dis foto come from, Kenya Red Cross/Handout via REUTERS
Ecuador intelligence chief and im wife don die for inside one helicopter crash wey happun for Kenya on Wednesday, 19 August.
Five Americans also die for di crash, one US State Department tok-tok pesin confam.
Michele Sensi-Contugi and im wife Stephany Hollihan dey among di seven wey die wen di accident happun for Samburu County at approximately 09:13 local time (06:13 GMT).
Kenya Civil Aviation Authority (KCAA) tok say di helicopter bin dey on scenic flight from one wildlife conservancy for Loisaba go Ewaso Nyiro, one river wey dey flow along several national reserves.
Images from di scene show smoke for di wooded crash site on Mount Ololokwe, as members of di Kenya Red Cross approach di still-burning wreckage.
Di Kenya Red Cross tell BBC say dem no fit access di yet, but dem dey use drones to assess di area.
Di KCAA say di accident involve one Eurocopter EC130 B4 and dem dey coordinate operations.
"Di National Government express dia most heartfelt condolences ova di sensitive passing of Michele Sensi-Contugi and im wife Stephany Hollihan," Ecuador presidential office tok for statement on X.
End of Di one wey oda users dey read well well
Former President of Ecuador Guillermo Lasso don pay tribute to di couple on social media, e say: "My solidarity and closeness to dia family members, friends, and colleagues for these moments of profound grief.
Dem name 44-year-old Sensi-Contugi director general of di Strategic Intelligence Center of Ecuador for 2024.
Lady Lori Helicopters, wey dey operate di Eurocopter EC130 B4 aircraft, say dem dey "deeply saddened" by di accident.
"Our deepest sympathies dey wit di guests, crew, dia families and loved ones, and all those wey dis tragic accident affect," one statement read.
According to one memo wey di BBC US partner CBS News see, one of di Americans wey die for di crash na NBC Universal journalist José Alberto Suárez.
For di memo, NBCUniversal call Suárez "a deeply respected leader and beloved friend and colleague.
"José na exceptional colleague and mentor to many," di memo read.
Dem neva identify di four oda American victims.
Earlier reports bin suggest say na seven pipo, six tourists and one pilot, bin die for di crash.
Di transport ministry and Air Accident Investigations Department go lead "investigations into di circumstances wey surround di accident", dem add.
Samburu county na popular tourist destination wey get many private wildlife conservancies and e dey popular for dia stunning scenery.
Helicopter crashes dey common for Kenya.
For February, one helicopter crash for di Rift Valley County of Nandi wey kill pipo, plus one member of parliament.
For 2024, di military chief, Gen Francis Omondi Ogolla, die afta one army helicopter wey bin carry 11 pipo crash for di west of di country, wit only two survivors.
For June 2021 at least 10 sojas die wen dia helicopter crash as e dey land near di capital, Nairobi.













