Wetin we know about death of 30 suspected oil vandals for Rivers State

Pipo gada for jetty wit local boats wey dey for di bank of di river.

Wia dis foto come from, The Youths and Environmental Advocacy Centre (YEAC-Nigeria)

Wetin we call dis foto, Pipo gada for jetty wit local boats wey dey for di bank of di river
Published
Read am in 3 mins

Ten youths don die for Okrika jetty for di riverine area of Rivers state Southern Nigeria, police confam.

But local media dey report say na ova 30 pipo kpai for di incident and search still dey go on to find more deadibody.

Authorities say dem don recover di deadi body of di young pipo wey pipo neva sabi wetin kpai dem.

Tok-tok pesin of di Rivers State Police Command Blessing Kaborlo Agabe say di suspects kpai wen dem bin dey try to tiff crude oil.

"Di suspects reportedly die in di process of attempting to steal crude oil," she tok, adding say no body don bring official complaint to to di police.

Police add say Investigation dey go on to establish di number of suspects wey kpai.

The Youths and Environmental Advocacy Centre (YEAC-Nigeria) don also confam di tori.

For statement wey Dr Fyneface Dumnamene Fyneface wey be di Executive Director, YEAC-Nigeria sign, im say na from dia network of youth volunteers and human rights defenders for di Niger Delta, Okrika Local Govment Area of Rivers State wia some pipo wey no dey less dan 37 die afta dem breathe "Indorama fuel".

According to di statement report, di pipo wey dem suspect to be oil tiffs die afta dem breathe in locally called "Indorama Fuel," and many pipo still dey miss.

For di statement Dr Fyneface say na for early mor-mor around 12 on Thursday morning e happun.

"Di incident occur at about 12:00AM on Thursday, September 3, 2026, for di Okari Jetty, Okrika Mainland area.

"Di volunteers say di youths bin connect pipe to one tapping point for one pipeline wey dey normally transport product from Indorama Eleme Petrochemical through di Port Harcourt Refinery to vessels wey dey come evri two weeks to load for export.

Crude oil tiff-tiff na one of di challenges for Nigeria oil and gas sector and e no dey new to di kontri.

Oil producing companies dey always complain how vandals dey go burst dia pipelines to tiff di product.

Na from dis product dem dey produce locally made petrol wey dey popular as kpo-fire.

Environment specialists too dey complain how dis oil tiff-tiff dey destroy di environment and do soil but dis pipo no dey hear word.

Nigeria govment dey do evritin to stop dem but no way.

Di Youths and Environmental Advocacy Centre (YEAC-Nigeria) dey call on di National Oil Spill Detection and Response Agency (NOSDRA) to carry out Joint Investigation Visit (JIV) to di site of dis incident and make dem chook eye for di pipelines to prevent dis kain incident.

"Di Advocacy Centre condemn dis act of sabotage by di youths and warn dem to stay away from oil and gas infrastructure due to di high pressure and associated dangers."