Why Obasanjo visit to Tigray dey cause tok-tok and wetin be im mission for Horn of Africa

Wia dis foto come from, Yasuyoshi CHIBA / AFP) (Photo by YASUYOSHI CHIBA/AFP via Getty Images)
Di Tigray People's Liberation Front (TPLF) don sama accuse on di African Union Special Envoy for di Horn of Africa wey be former Nigerian president Olusegun Obasanjo.
Dem dey accuse am say e dey partial as im dey try to do evritin make civil war no happun again for di Tigray region for Ethiopia.
Dis dey come afta di former Nigerian leader bin visit Tigray two weeks ago wia im bin meet wit di Tigray regional President Debretsion Gebremichael.
Recently di Tigray People's Liberation Front and di federal govment of Tigray bin don dey gada forces for di border of di northern region.
Dis move bin dey raise fears say di kasala of war fit come back like di one wey bin happun for 2020-2022 wey bin kill about 600,000 pipo.
Wetin Obasanjo bin do to end di Tigray war
For 2020 di Henry Dunant Centre bin invite former Nigerian President Olusegun Obasanjo wey bin dey stay for Abeokuta, southwestern Nigeria for Humanitarian tok-tok.
Di tok-tok na to chook eye and find way to end di kasala for di conflict Tigray region of di Federal Democratic Republic of Ethiopia to negotiate between di parties wey dey fight each oda.
Oga Obasanjo accept di assignment wey oda pipo bin don try to do wey bin no dey successful.
According to one commendation letter wey HD Centre for Humanitarian Dialogue bin write to Obasanjo on 25 April, 2023, di organisation tok say "President [Obasanjo] bin work tirelessly for many months, without any official mandate, wit di parties wey dey cause di kasala and wit di most senior leaders of neighbouring kontris and wit di envoys of oda interested kontris and international organisations, wey dey travel constantly throughout di region to find common ground..."
Di letter acknowledge say afta former Nigeria President Obasanjo accept to do di work na im di African Union bin appoint am as di High Representative for di Horn of
Africa.
"...wit infinite difficulty, a formal peace process bin move forward and di parties wey dey fight kon agreed to meet for Pretoria, South Africa during October and November 2022.."
Na for dat meeting wey dem sign di Agreement for Lasting Peace through Permanent Cessation of Hostilities wey representatives of di Federal Democratic Republic of Ethiopia and di Tigray
People's Liberation Front (TPLF) bin sign on 2 November 2022.
Olusegun Obasanjo and di Moussa Faki Mahamat wey be di Chairman of di Africa Union Commission, plus oda ogbonge pipo like Uhuru Kenyatta, former President of Kenya and Dr Phumzile Mlambo-Ngcuka, former Deputy President of South Africa bin sign di ceasefire deal too.
"Noting wit great satisfaction and relief say force-and-force military operations for di theatre of war kon stop and dem neva start again; wit concern say full security and normalisation bin neva still return to di areas wey di war bin affect...
Grateful for im Excellency continuing efforts to make sure say di permanent cessation of hostilities dey fully implemented and follow a wider peace throughout di Federal Democratic Republic of Ethiopia."
"Di Foundation Board of di Henry Dunant Centre for Humanitarian Dialogue dey honoured to acclaim former President Obasanjo for im Mediation for Peace." di letter conclude
Wetin di Tigray region dey ask govment for
Even though dis mata happun few years ago, tok-tok about am start afresh afta Olusegun Obasanjo afta e visit di region on 24 August, 2026
According to local media for Ethiopia, Obasanjo bin visit Mekelle on August 24 and im bin meet wit Tigray regional President Debretsion Gebremichael.
Di visit happun sharp-sharp witout planned arranagement made without prior appointment, according to statement from di Office of di Press Secretariat of di Tigray Regional President
Tigray regional authorities say di tok-tok wit di former Nigerian President Olusegun Obasanjo wen im bin visit Mekelle no bring any new proposals or tangible progress from Ethiopia federal govment on issues wey dem tink say go bring peace and stability for all of dem.
According to Addistandard Tigray authorities dey diasppointed sake of say no meaningful follow-up to discussions wey bin happun for June, wen dem bin identify five issues as possible entry points for dialogue wit di federal govment.
Some of di areas wey dem bin identify include:
- Lifting wetin den describe as economic embargo and siege.
- Dem want di military encirclement and tension of di security situation to reduce.
- Dem wan make dem restore di territories wey dem still dey occupy.
- Facilitate di safe and dignified return of internally displaced pipo.
- Make dem restore di legal and political status of di Tigray People's Liberation Front (TPLF)
How Obasanjo and European Union react to dis mata
For statement wey former Nigeria President Obasanjo release about di mata on 7 September, 2026 im tok for statement wey im tok-tok pesin Kehinde Akinyemi sign, im tok say" If dem fit accuse President Obasanjo of anytin, na say e recognise di futility of imposing di wishes of one party on anoda. Mediation, and indeed dialogue, no go fit dey imposed on parties even by di pipo wey get best intentions. Wen demands no dey accepted or expectations no dey met by di oda party for conflict, di solution no be to attack di mediator or question his/her seriousness. Di solution na to continue to explore dialogue until we find common ground.
Meanwhile for statement wey di European Union External Action (EEAS)bring out on Tuesday 8 September, 2026 dem tok on behalf of di 41 kontris for Europe say dem dey follow di developments for Tigray Regional State wit great concern.
"New military confrontation for Tigray go get severe consequences for di region wey dey already face drought and significant humanitarian needs. We dey call make dem reduce and avoid any actions wey go jeopardise di Permanent Cessation of Hostilities Agreement, signed in Pretoria in November 2022."
Di European Union add say dem "fully support di AU-led mediation process and welcome renewed consultations by AU High Representative for di Horn of Africa, former President Obasanjo, including im recent visit to Ethiopia and im meetings for Addis Ababa and Mekelle.









