Tanzanian bury President Samia Hassan husband wey die of heart disease

Wia dis foto come from, Alexander KAZAKOV / POOL / AFP via Getty Images
Dem don bury di husband of Tanzanian President Samia Suluhu Hassan, Hafidh Ameir Hassan for Kizimkazi, Zanzibar.
Oga Ameir, di late First Gentleman wey dem born on 01 January, 1946 leave behind two widows, four children and 15 grandchildren.
E die on Monday (07 September), afta e suffer from heart disease.
For di official announcement of Ameir death, Tanzania Vice-President Deogratius Ndejembi tok say Oga Ameir die at 08:00 local time (05:00 GMT) on Monday for Emilio Mzena Memorial Hospital for Zanzibar, wia e bin dey receive treatment for a heart condition.
"Na wit great sadness I inform you of di death of Mr Hafidh Ameir Hassan, husband of di President of di United Republic of Tanzania, Samia Suluhu Hassan," Mr Ndejembi tok.
E extend im condolences to President Hassan, her family, relatives and friends, as well as Tanzanians afta di death.
Zanzibar Grand Mufti, Sheikh Saleh Omar Kaabi lead di funeral prayer wey senior political and religious leaders, including Vice-President Deogratius Ndejembi and Zanzibar President Hussein Mwinyi attend.
African leaders pay tribute to President Samia

Wia dis foto come from, State House Tanzania
President Samia neva tok anytin about di death of her husband as at di time of dis report, however Tanzanians don begin mourn and African leaders and pipo don dey pay tributes.
Di African Union and Presidents of Kenya, Burundi, Zambia, Rwanda, Ethiopia, Senegal, dey among dos wey don express dia condolences to President Samia, her family and di pipo of Tanzania.
Chairperson of di African Union (AU) Commission, Mahmoud Ali Youssouf for one post on X extend im condolences to di Tanzanian leader ova di demise of her husband.
"I extend my profound sympathy to H.E. President Samia and her family during dis difficult period and dem strength, courage and solace," e write.
Kenya President William Ruto for im tribute say im receive di news of Oga Hassan passing wit great sorrow.
E extend im condolences to di President and di pipo of Tanzania.
"President Samia don lost a lifelong companion, her children a beloved father, and Tanzania a distinguished son.
"Kenya stand wit our Tanzanian brothers and sisters for dis moment of grief. May Almighty God comfort President Samia and her family, give dem strength through dis difficult time, and grant Hafidh Ameir Hassan eternal rest," Oga Ruto add.
Burundi President Evariste Ndayishimiye also express condolence to di pipo of Tanzania. "For dis hour of grief, Burundi stand firmly beside our Tanzanian brothers and sisters. May di Almighty grant President Samia and her family comfort and strength for dis difficult moment, and may He grant eternal rest to di soul of Hafidh Ameir Hassan".
Africa CDC for dia tribute tok sorry to di president and say dem stand wit her during dis time of sorrow.
Hafidh Ameir na agricultural academic wey specialise in agriculture. E mostly keep low public profile, as pipo no too dey see am for public.
Who be Hafidh Ameir Hassan?
According to information wey di State House release, dem born Mr Ameir for Kisakasaka village for Unguja, Zanzibar.
E complete im primary education for Kombeni Shakani School for West B District in 1960, bifor e attend Tumekuja Secondary School in Mkunazini, wia e graduate for 1965.
For 1970, e join Zanzibar Teachers' College and graduate three years later. E then work as a teacher for plenty schools for Tanzania.
Im career later shift towards agriculture. For 1980, e begin dey agriculture for Uyole Agricultural College for Mbeya, southern Tanzania. Two years later, e bicom agriculture instructor for Fidel Castro School for Pemba, Zanzibar.
For 1986, e go Sri Lanka for further studies, and e receive diploma in agriculture for 1988, e specialise for coconut farming. Afta e return to Zanzibar, e continue to dey work wit di Ministry of Agriculture.
For 1990, e travel go UK to pursue master's degree in agricultural machinery engineering. E later return to Zanzibar afta e finish im studies and remain for di Ministry of Agriculture until im retirement for 2005.
Even afta retirement, Mr Ameir continue to dey teach for Kizimbani Agricultural College for Unguja.
E marry Samia Suluhu for 1978, bifor she enta national politics. Di couple get four children - three sons and a daughter.
Ameir bicom Tanzania First Gentleman wen im wife bicom president for 2021.
E no dey too appear for public alongside di president, although, pipo dey occasionally see dem togeda for official and political events.
Dia daughter, Wanu Hafidh Ameir, also na politician wey currently dey serves for Zanzibar House of Representatives for di National Assembly.
E mostly keep low public profile.
Fotos from di burial

Wia dis foto come from, STATE HOUSE TANZANIA

Wia dis foto come from, State House Tanzania

Wia dis foto come from, State House Tanzania









