Who be di Nollywood actress Tope Osoba wey kpai at di age of 40

Di late Yoruba feem actress, Temitope Osoba

Wia dis foto come from, Osobatemitope instagram

Wetin we call dis foto, Tope Osoba family announce di passing of di actress on Wednesday
Published
Read am in 3 mins

Family and friends of Nollywood actress Tope Osoba still dey mourn afta her family announce her death on Wednesday, 5 August, at di age of 40.

For statement wey di family of Awonuga sign, dem tok say di actress die on 5 August, 2026.

"Na wit profound sadness and heavy hearts wey we announce di passing of our beloved Osoba Temitope Olamidisun, wey depart dis life on 5th of August, 2026."

Di statement describe Temitope as pesin wey be more dan public figure.

Di family add say pipo for di family value her well-well as she inspire plenty pipo and touch lives wit her talent and kindness.

"Her legacy go continue to live for di hearts of evrione wey bin get di privilege of knowing her and supporting her journey."

Di family ask for prayers "during dis incredibly difficult time" as dem dey mourn dis loss wey dem no fit measure.

Tributes dey pour in from Tope friends and associates.

One of her friends and associate post emotional tribute about her for Instagram, Alesh Ola Sanni describe her as a dear sister and reflect on di memories wey dem bin share.

"I no fit sleep since last night it is well rest in peace my dearest sister Temitope Osoba we bin get amazing time and good memories togeda till we meet again. I really no know wetin to tok mehn gosh."

Tori be say di actress wey bin dey sick, bin ask di public for financial assistance for November 2024 to support anoda surgery as she bin dey continue her treatment.

For 2025, Osoba bin reveal say she bin do surgery and radiation treatment afta she bin discova one lump for her breast during self-examination.

She bin later announce say she don free from cancer as she bin tank pipo for dia financial and emotional support wey bin help her through di treatment process.

Tori be say Osoba bin do breast cancer surgery bifor but she bin still dey battle complications from di sickness.

Pipo sabi Osoba well-well sake of her acting talent for di Yoruba movie industry.

She don act as different characters for family dramas, comedies and traditional-themed productions.

Some of di feems wey she act na Ile Owo, Omo Iya Kan and Gucci Girls.

Who be Temitope Osoba?

According to local tori pipo Punch Newspapers, dem born Temitope Osoba for Lagos Nigeria and na for dia she grow.

She study for Olabisi Onabanjo University, Ogun State wia she get Bachelor of Science degree for Business Education.

Osoba start her Nollywood career around 2005.

She become popular afta she act for Oogun Mi, one Yoruba movie wey actress Dayo Amusa bin produce.

Osoba dey popular for Yoruba language feems and she don dey act for nearly 20 years.

She bin also produce her own movie 'Single Ladies'.

On August 4, 2025, she bin post one emotional video wia she announce say she don come back to di movie industry afta she survive cancer.