A$AP Rocky don reveal Rihanna dey 'cook' for studio, na album?

Wia dis foto come from, Neilson Barnard/MG26/Getty Images for The Met Museum/Vogue
Rihanna fit dey readi to break her ten year album break. Dis dey come from her partner, A$AP Rocky.
Di rapper bin tok for di Jason Lee podcast on Wednesday say, "She dey for studio right now."
Dem neva share plenti tins about di project. But one of di tins wey dem don release be say, dem two no dey do album togeda.
But to ansa question as to weda wetin Rihanna dey find for inside studio na new album, her long time partner, just add say "she dey cook."
Wetin make pipo tok wella on to dis mata be say, di musician and business woman wey her real name na Robyn Fenty neva drop full album since Anti wey she bin release for 2016.
Di fact say for July, Rihanna climb stage for Jay Z concert just dey create more ginger to dis claim of new music.
For di interview, di podcaster Jason Lee bin ask di rapper if na im cause Rihanna to neva release album, sake of di three pikin wey dem don born togeda and all di waka she dey waka but im tok say no be so.
E add say she dey infact work on new music. E tok for di podcast say, "Yes I don tok am, sorry babe" as e add say e go "enta wahala for dis".
All dis dey happun, as Rihanna recently drop Insta stories wia she and her partner go participate for di festival for Barbados as she dey whine am give her man, dis week.
But dis no go be di first time, dem go leak informate say, Rihanna fit come back wit new album o!
For February of last year, Rihanna tok say, she bin feel "really optimistic" about new album.
She bin tell one tori pesin from Harper's Bazaar say, "I feel like I don finally crack am girl. I no fit just drop anytin mediocre. Afta una don wait eight years, you gatz just wait some more".
But afta dat update, wetin come drop na her daughter for September 2025 wey she name Rocki Irish Mayers.
But for February dis year, di mama of three don release night in di life video wey feature wetin she dey do as businesswoman and mama but also show her for inside studio.
So wetin be di oda tins wey she don drop for studio instead of album since her 2016 Anti album?
Smurfs - 2025

Wia dis foto come from, Unique Nicole/Getty Images for Paramount Pictures
For February, 2025, wit di interview wey she give on the possibility of new music, na wen she reveal say she bin act inside di cartoon feem, Smurf.
Rihanna no only play di role of Smurfette, di only female Smurf for di feem but she also contribute inside di soundtrack for di feem.
At di end of di day di song wey we get from dat project, na wetin dem dey call Friend of Mine.
Super Bowl Half Time Show - 2023

Wia dis foto come from, Focus on Sport/Getty Images
Anoda time wey pipo bin reason say new music go fit drop but nothing like dat happun na for February 2023, wen she bin perform for di Super Bowl Half Time show.
Bifor den, she bin tok say, she go fit bring pesin for di free half time concert.
But nobodi see any guest start and she bin sing her past hits like,
- Better Have My Money
- Where Have You Been
- Only Girl (In The World)
- We Found Love
- Rude Boy
- Work
- Wild Thoughts
- Birthday Cake (instrumental)/ Pour It Up
- All of the Lights
- Run This Town
- Umbrella
- Diamonds
Howeva, even though she no bring any star, she bin unveil di belle wey she carry for her second pikin, Riot for dat stage show.
Black Panther - 2022
Following di death of di actor wey play di lead for di feem Black Panther, Chadwick Boseman, most of di second feem in di Marvel Franchise, Black Panther: Wakanda Forever bin dey focused on mourning im character we, T'Challa wey dey kpai for di feem.
Rihanna enta studio again for dis one to release two songs on top di original music wey bin dey prodcued for dis projects.
Di songs na Lift Me Up wey Nigerian musician, Tems bin follow write and di second one na Born Again.
Di director of di feem, Ryan Coogler bin reveal dat time say she bin do am to honor Chadwick Boseman.
E bin tok say, "plenti unlikely tins bin need to happun for am to click but Rihanna bin dey very cear say she do am for im".
Coogler bin add say, "We bin know say Rihanna bin dey di point for her life wey she bin dey focus on different tins like business and motherhood, wey be big theme for our feem. We bin dey hold out hope say maybe e go work out and omo e work for dis song."
Acting for Ocean's 8 (2018) and Guava Island (2019)

Wia dis foto come from, Jamie McCarthy/Getty Images
Apart from music, wey she drop wey no turn album ova dis ten years and di businesses wey she dey run for beauty, fashin and skincare wey she call Fenty, Rihanna don chook her hand put inside some acting roles.
One of di first feem wey she follow act na Ocean's 8 wey be part of di Ocean's series of movies but dis time na all women band of theinves.
Ocean's na thriller series of feems wey dey follow a group of criminals as dem dey take tiff for large robbery heists.
Di origina feem for dis series, Ocean's 11 bin comot for 2002 and feature stars like George Clooney and Matt Damon and even Julia Roberts join.
Di one wey Rihanna follow dey inside bin get Heorge Clooney to come back to im role but also get stars like Sandra Bullock, Cate Blanchette, Anne Hathaway and Helena Bonham Carter.
Di next one wey cast Rihanna, na Donald Glover short feem wey dem call Guava Island.
Tori be say di feem an sgort feem wey show for di first time for Childish Gambino set for Coachella.
Di tori na about one musician, Deni Maroon wey Donald Glover bin act as wey bin dey try organise festival for di pipo of Guava.
And Rihanna bin act as im long term babe wey dem call Kfi.
Fenty Beauty - 2017
Bifor she confam her relationship wit rapper, A$AP Rocky or even drop clue say she dey take break from music, Rihanna lauch her make up like Fenty Beauty for 2017.
Dis na collabo between ger and di luxury goods company LVMH.
Rihanna bin reveal for interview dat yearsat her goal for di company na to to fit appeal ot "evri kain woman" wit "all skin tones".
From dia, Rihanna don torchlght many oda businesses wey include ger underwear line wey she call Savage x Fenty.
She don also get side business on skincare wey she call Fenty Skin and also fashion line but dem later close am for February 2021.
But dat no stop Forbes to name am di richest female musician for work as dem announce say she join billionaires club.
Dem estimate say her net worth reach $1.7bn and most of that money dey come from her Fenty Beauty ($1.4 bn) and her underwear line, Savage x Fenty ($270 million).










