Spain outclass France 2-0 to qualify for 2026 World Cup final

Spain outperformed favourites France in the semifinal

Wia dis foto come from, FLORENCIA TAN JUN/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, La Roja go play only dia second World Cup final for 19 July for di New Jersey stadium
Published
Read am in 3 mins

Spain don qualify for di final of di 2026 World Cup afta dem sama favourites France 2-0 for di semifinal.

Goals from Mikel Oyarzabal and Pedro Porro sink di hearts of Le Bleus and prevent wetin go become dia third consecutive final.

Spain bin dominate di game from di beginning to di end wit dia possession wey dem take dia chances to win di game.

France wit dia star players Kylian Mbappe, Michael Olise and Dembele no fit find di way to score for dis game.

France defender Lucas Digne bin kick Yamal wey di referee award di penalty – Real Sociedad captain Mikel Oyarzabal step up wey im score di penalty for di 22nd minute.

La Roja almost score one of di goals of di tournament afta Rodri, Olmo and Yamal combine wit some fine passes for Fabian Ruiz, but di PSG midfielder fail to score.

From dat point, Unai Simon also comot to clear at least two dangerous balls behind di defence to keep di score for 1-0.

france will have to settle for a third and fourth game on Saturday

Wia dis foto come from, PABLO MORANO/BSR/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, France fail to reach dia third consecutive final at di World Cup

But Spain create di second goal for di 58th minute afta defender Pedro Porro begin di attack wey im enta di box to score afta Olmo knock di ball to di Tottenham player inside di box.

Spain goalkeeper Unai Simon make three saves for di last 10 minutes of di game from Dembele to keep di score at 2-0.

At di end Spain get 51% of possession wit 10 attempts and two shots on target.

La Roja complete 434 passes wey France get 395 passes.

France 49% of di ball, wit 10 shots and three shots on target.

Les Bleus also bin get seven corner kicks but dem no fit find di goal.

Mbappe fail to score for di second time for dis tournament, afta im fail to score for dia 4-1 win against Norway for di group stage.

Kylian Mbappe still get eight (8) goals wey Dembele get five (5), Barcola get two (2), wey Desire Doue also get one (1) goal.

For Spain Mikel Oyarzabal increase im goal tally to five (5), Mikel Merino remain on two (2), Yamal (1), Baena (1), Pedro Porro increase im tally to two (2).

Fabian Ruiz still get one goal.

Wit dis 2-0 result, Spain don defeat France for three consecutive times, 2-1 for di Euro 2024, 5-4 for di Nations League wey dem now win 2-0 for dis World Cup.

Dem go play dia first final since 2010 when dem win am against Netherlands.

La Roja go face winner of di second semifinal game between England and Argentina for di final for 19 July for di New York/New Jersey stadium.