Blue Origin rocket explode into big ball of fire for Florida launch pad
- Author, Sareen Habeshian
- Published
- Read am in 3 mins
One rocket wey Blue Origin company make explode for di launch pad for Florida wen dem bin dey test am.
Video show as di rocket dey burst into massive ball of fire, wey cover di area around am.
For statement on social media, Blue Origin say "dem bin don experience say sometin no dey okay" during di hotfire test. Dem add say all dia personnel dey accounted for.
Na Amazon billionaire Jeff Bezos start di space technology company for year 2000.
Di explosion happun place around 21:00 local time (02:00 +1 GMT) for Cape Canaveral. According to Brevard County Emergency Management, e no threaten di public.
Bezos write for social media say all personnel dey safe and accounted for.
"E dey too early to know di root cause but we don start work already to find am," im tok. "Veri rough day, but we go rebuild anytin wey need rebuilding and we go get back to flying. E worth am."
Di US Space Force say emergency responders dey di scene and officials dey work wit Blue Origin to evaluate available data to determine di exact cause of wetin go wrong.
Di explosion happun wen dem bin dey do test ahead of upcoming launch.
NASA Administrator Jared Isaacman tok for X say: "Spaceflight no dey forgive, and to develop new heavy-lift launch capability dey extraordinarily difficult. We go work wit our partners to support a thorough investigation of dis incident, assess near-term mission impacts, and get back to launching rockets."
Di Federal Aviation Administration (FAA) tok for statement say dem dey aware of di incident.
"Dis test bin no dey within di scope of FAA licensed activities," di agency tok, dem add say e no get any impact to air traffic.
Just last month, Blue Origin newest rocket bin dey grounded afta di Federal Aviation Administration (FAA) order investigation into one "mishap" we involve di failed launch of one satellite.
Di company bin attempt to place di satellite from AST SpaceMobile wit dia New Glenn rocket but dem bin no fit make am go as far into orbit as dem bin want am.
Di space company successfully launched one New Glenn rocket from Florida last November, as e landing dia reusable booster for di first time.










