Russia hit Ukrainian train afta former UK Prime Minister Boris Johnson and oda top European officials dey comot

Wetin we call dis Video, Watch: Why Russian strike on train near Ukraine-Poland border fit be di mark of escalation
    • Author, Jaroslav Lukiv
  • Published
  • Read am in 5 mins

Russian drone hit one train wey dey near di Ukraine-Poland border just afta di former UK Prime Minister Boris Johnson and top European security officials bin don waka pass dat same train.

No casualties bin dey reported afta di strikes at Yahodyn wey sama di train engine. Ukraine authorities tok say all di passengers don dey evacuated.

Boris Johnson and all di oda European national security advisers, wey include UK Jonathan Powel; bin pass dat same line for different train as dem dey come back from conference wey dem bin go for Kyiv.

Russia tok say dem bin hit "rail infrastructure" for western Ukraine but Ukraine state railway company Ukrzaliznytsia tok say "e dey possible say di drone bin dey target di diplomatic train".

Former CIA chief David Petraeus, wey bin dey inside anoda train for Yahodyn station wen di strike bin happun tok say di mata bin dey "terrifying".

For interview wit di New York Times, Petraeus tok say, "dis na act of truly barbaric leader wey try to terrorize Ukrainian civilians."

For statement, Ukrzaliznytsia tok say di diplomatic train "bin comot earlier dan dem bin plan sake of timetable change... sake of constant threats of Russian strikes".

E also tok say evacuation order for passengers for di train wey dem bin hit bin get "just 15 minutes" bifor dem bin dey hit wit Russia jet drone.

So Ukrainian people and Polish pipo toksay Russian drone come hit ground just 2km (1.2 miles) from Poland border. Even former Swedish Prime Minister, Carl Bildt, wey dey di conference for Kyiv too, tell BBC wetin happun for im train.

Im say: "Na for di train I dey o. Dem stop di train and tell us make we ready make dem evacuate us. But afta small time dem come say everywhere don dey okay, make we continue our journey."

Las-las, sha di train reach Poland border for Dorohusk safely. No casualties.

Wetin we call dis Video, Watch: Moment Russian strike hits near Ukraine-Poland border

Some reports tok say Bildt dey di same train with Johnson, but di former UK prime minister neva confam anything.

Johnson bin write for X say, "I no know wetin make Putin get di craze to blow up Ukrainian train wey dey park for Poland border this morning."

Im talk say dis na "di kind of useless and senseless attack wey Ukrainians dey face everyday — even for civilian trains" and im beg Kyiv allies make dem quick-quick give Ukrainians "di air defence wey dem need".

Ukraine don dey beg dia allies plenty times — especially US — make dem send more interceptors to defend dem from Russian attacks wey dey happen everyday.

Di attacks now dey use fast ballistic missiles and jet drones.

Boris Johnson in Lviv September 2026

Wia dis foto come from, Global Images Ukraine via Getty Images

Wetin we call dis foto, Johnson, dey hia for book fair for Lviv last week, bin dey di train wit top European security officials

Ukrainian Foreign Minister Andrii Sybiha tok say di "wicked strikes" for Ukraine-Poland border for Yahodyn be like "[Russian President Vladimir] Putin own terror dey 'knock' directly for EU and Nato door" and im call again make dem put more sanctions on Moscow.

Im talk say, "Putin need to understand say we go meet im wickedness with strong action. We go make di cost of war too high for am, until e no go dey acceptable again. Na only like that we fit stop am."

For Poland side, Prime Minister Donald Tusk hold emergency meeting to discuss di latest wahala.

Im say: "Russian pipo dey increase dia attack small-small. E don dey real now, and dem dey come closer and closer to our border."

Johnson and other big European security advisers dey come back from Yalta European Strategy (YES) conference for Kyiv — na yearly gathering wey dey bring togeda leaders and sabi pipo from politics, business, security and tori pipo.

map

E be like say Russia dey increase dia war against Ukraine by targeting trains, railway stations, petrol stations and border points

.Earlier dis week, two pipo kpai wen Russian drones knack di border crossing between Ukraine and Moldova, na wetin Ukrainian President Volodymyr Zelensky tok.

Also dis week, one female conductor die for Russian drone attack on passenger train for southern Ukraine.

And for di start of dis month, six Ukrzaliznytsia workers die afta dem hit railway depot for Kyiv.

For January too, Zelensky call am "terrorism" wen Russia bomb crowded passenger train for north-eastern Kharkiv region. Five pipo die for dat one.

All dis Russian attacks don spoil Ukraine train system well-well — and train na di main way millions of Ukrainians dey waka, bicos dem don ban all flights since Russia start full war for 2022.

European kontris too dey blame Russia for some suspicious things wey dey happun for dia side.

Last week, Germany tok say Russia dey behind di drone attack for Leipzig airport for August — but Moscow say na "nonsense" tok be dat.

Plenti suspicious fires don also happun for defence facilities from Italy to Estonia and some kontris don dey point hand to Russia.