How gunmen enta church shoot pipo during burial service

Several security personnel surrounded by cars in a car park in Jordan.
Wetin we call dis foto, Between 150 and 200 pipo dey for di church at di time of di shooting, according to one witness
    • Author, Jamie Whitehead
    • Author, Jacob Phillips
  • Published
  • Read am in 4 mins

Seven pipo dey killed for one attack during a funeral for central Jordan, officials say.

At least 34 odas dey injured as gunmen open fire on one church for Hmoud, in di Karak governorate on Friday.

Di unidentified gunmen dey reported to arrive in a car, enta di church and open fire bifor dem run comot.

No one don admit say dem carry out di attack.

For news conference, Interior Minister Mazen al-Faraya say authorities dey work to catch di perpetrators wey dem describe as "group of extremists".

Jordan King Abdullah II, say di authorities go "confront di terrorist act wey target Karak wit di harshest penalties".

"Whoeva imagines say di bullets of treachery fit divide di ranks of Jordanians go fail for im endeavour bifor our steadfastness and unity," di king add for post on X.

Dozens of pipo dey inside di church for di funeral wen di shooting begin, Khaled Burqan, one of di mourners, tell Jordan al-Mamlaka state-run TV.

E say two attackers armed wit rifle and pistol dey fire at di mourners for several minutes.

Al-Faraya add say di incident dey "painful and horrific" and "unparalleled in di history of di Hashemite Kingdom of Jordan," during im news conference.

Public service television station al-Mamlaka don report say di king arrive for Karak on Friday evening "to check on di condition of di injured pipo".

How di attack take happun

Security officials and public outside Greek Orthodox church wia attack happun in Jordan.
Wetin we call dis foto, Security officials and members of di public gada outside di Greek Orthodox church on Friday

Initial reports indicate say seven pipo dey killed for di attack. One govment tok tok pesin later say six pipo don die, bifor officials again revised di death toll to seven.

CCTV footage, verified by di BBC, appear to shows three gunmen making dia way from road toward di church.

Two of di attackers dey seen dia way on to wetin appear to be a vehicle entrance to di church grounds, bifior retreating briefly and returning wit third man. All three appear to be armed wit handguns.

Separate footage believe to be from di aftermath of di attack appear to show several dead and wounded bodies on di ground amid some chaotic scenes.

Wetin we call dis Video, Watch: CCTV footage appears to show gunmen near church

Scenes of panic break out inside di church as pipo throw demsef under pews searching for cover, moving away from di windows.

Prayers and screams dey loud heard throughout di building as some try to run.

Witnesses described seeing a "harrowing scene wit casualties lying on di ground and blood across di area".

E get heavy security presence for di entrance to hospital wey dey treat pipo injured in di incident in Karak, amid atmosphere charged wit anger among residents of di governorate, particularly di families of dose wey injure and killed.

Many looked distressed as roads dey closed around di facility and pipo dey forced to park dia cars and kontinue on foot.

Security measures dey also tight ahead of di visit by King Abdullah II to check on di injured pipo.

Di atmosphere around di hospital remain tense as di sound of crying and shouting dey loud from families wey dey mourn dia loved ones.

Many pipo appear shocked, frightened and angry. Some express frustration at wetin dem described as "a failure to take a tougher approach towards terrorists".

Karak get sizeable Christian community in di majority-Muslim Jordan.

Such violence dey rare in di kontri, but deadly attacks don happun for di past.

Lebanon President Joseph Aoun, a Christian head of state, say "heinous terrorist attack" on di church "violate di sanctity of death and funeral mourners, contradicts all religious and humanitarian values," according to Lebanese media.

Additional reporting by Majd Gousous, BBC Arabic.

Map of Jordan showing di location of Hmoud in di west-central part of di country, south-west of Amman and near di Dead Sea. Neighbouring countries Israel and Saudi Arabia dey labelled, wit locator globe showing Jordan position in di Middle East.