CNN founder Ted Turner die at di age of 87

Wia dis foto come from, Getty Images
Media mogul Ted Turner, wey bin pioneer di modern 24-hour news culture wen e launch di CNN channel, don die at di age of 87, di network don announce.
Turner bin launch Cable News Network as di first dedicated rolling news channel, for 1980, wey soon become central part of di media landscape.
"Ted na intensely involved and committed leader, intrepid, fearless and always willing to back a hunch and trust im own judgement," CNN CEO and chairman Mark Thompson tok for inside statement.
E say Turner go always be di presiding spirit of CNN. E say Ted na di giant wey dem stand on im shoulder and dem go take a moment today to recognise am and im impact for dia lives and di world.
"E be and always go be di presiding spirit of CNN."
President Trump na fierce critic of di current CNN, but for im tribute to Turner, e say: "Whenever I need am, e dey there, always willing to fight for a good cause!"

Wia dis foto come from, Getty Images
CNN bin initially struggle, but prove dia worth by providing speedy and continuous coverage of stories like di assassination attempt on US President Ronald Reagan for 1981, and di Challenger space shuttle disaster for 1986.
Di network truly come of age wit dia rolling updates on di 1990-1991 Gulf War.
President George Bush bin once tok say im learn more from CNN pass wetin e learn from di CIA.
CNN success bin lead oda news channels to follow, like Fox News, wey Turner long-time rival Rupert Murdoch launch for 1996.
But CNN bin dey far from Turner only outlet. E begin im career by taking ova di successful family billboard company wen im papa take im own life, den e buy one radio station for Atlanta, Georgia.
Within a decade, dat station become di foundation of di Turner Broadcasting System (TBS) and Turner na one of di United States biggest media moguls.

Wia dis foto come from, Getty Images
Im television empire also include di TBS and TNT channels, Turner Classic Movies and Cartoon Network.
E acquire di MGM film studios for 1985 for $1.5bn (£1.1bn). E later buy feem and TV companies Castle Rock Entertainment and New Line Cinema for di 1990s, bifor im company merge wit Time Warner.
Beyond di media, Turner na world-class yachtsman, e win di America Cup for 1977, and e be di owner of Atlanta Braves baseball team, Atlanta Hawks basketball team and Atlanta Thrashers ice hockey team.
E dey married to actress Jane Fonda from 1991 until 2001.










