World youngest traditional monarch die of 'aggressive cancer' at age 34 – Presidency confirm

King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV, dey look afta im crowning ceremony for Fort Portal on April 17, 2010.

Wia dis foto come from, ROBERTO SCHMIDT/AFP via Getty Images

Published
Read am in 3 mins

Uganda President Yoweri Museveni say di King of Tooro, Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV wey die at di age of 34 on Thursday, 27 August die of cancer.

Di Ugandan leader for one statement on X wia e take extend im condolence say di late monarch, wey be di youngest traditional leader for di world bin get "cancer wey dey very aggressive.

E say di govment bin support am to go Germany for treatment and den US, wia e later die.

"Some months back, Her Royal Highness Kemigisa, Nyinomukama, bin tell me say di Muzzukulu Oyo get cancer and e dey very aggressive. Di govment bin support dem to go Germany and, den, di USA wia e die."

President Museveni say dem go give di late traditional ruler official burial, and don direct make all di flags fly at half-mast for three days.

"Di three days na: di day of di burial, di day bifor and di day afta. May im soul rest in eternal peace," e tok.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

President Museveni wey lead di tribute say life no dey fair as Ugandans mourn di death of di young monarch.

"His Highness Oyo, di King of Tooro at such a young age of 34. How unfair life fir be!! E lose im parent for a very young age, now imsef don die young."

E however say good news dey, as di late king leave heir wey dem go introduce to di public at di right time.

Who be King Oyo

In 2001 King Oyo (R), nine at the time, welcomed Libyan leader Muammar Gaddafi (L) to the Tooro kingdom alongside Ugandan President Yoweri Museveni (C)

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV bicom king of Tooro for western Uganda wen e just be three years old for 1995 afta di death of im father.

Although na elected president and parliament dey rule Uganda, di kontri get plenty traditional kingdoms wey get significant cultural influence even though dem no get political power.

Oyo, wey Guinness World Records list as di world youngest reigning monarch, bin rule ova more dan two million pipo. E be di 13th monarch of di kingdom wey dem establish for di early 19th Century.

Tooro Prime Minister, Calvin Armstrong Rwomiire Akiiki wey announce im death bin call im an "immeasurable loss" to di royal family and di pipo of Tooro.

"I call upon all di pipo of Tooro to remain united, calm and prayerful during dis profoundly difficult time," Akiiki tok on Friday. "May His Majesty di King rest in eternal peace."

Di Tooro Kingdom dey follow hereditary system in selecting dia monarch.

Oyo officially no dey married, but Akiiki say "di continuity of di Crown dey settled".

"His Majesty leave behind a Prince as im heir, whose identity we go formally reveal for di appropriate time, in accordance wit di traditions and customs of Tooro Kingdom," explain.

Wen e bicom king for 1995, dem establish one regency, wey include di queen mother, until Oyo turn 18 wen dem do official coronation.

Di young king dey well respected by im pipo and according to one report for di Daily Monitor newspaper, e bin promote causes like youth empowerment, education and climate conservation, and HIV/Aids awareness.

Di kontri largest and most influential traditional institution, di Buganda Kingdom, say dem mourn wit di pipo of Tooro following di death of dia monarch, as dem label am a valuable figure to Uganda.

Similarly, di Rwenzururu Kingdom also extend dia condolences to "all di pipo wey dey mourn dis great loss", according to local media reports.

Odas don also pay dia respects to di late king.

Di Federation of Uganda Football Associations, honour King Oyo as "true friend of di beautiful game", and e announce a moment of silence bifor di kick-off of all matches until 4 September in memory of im "legacy, love, passion and contribution" to di sport.

Di govment minister Margaret Muhanga describe di mood for di kingdom as "sombre... nobody dey smile".

Di king bin dey for "di prime of im life", she tok for one video on social media, "as young as e be, e make impact on im kingdom".

Muhanga said dem go plant one million trees for im honour during di mourning period, and wnat make neighbouring districts for Tooro to do di same.

Uganadan musician Juliana Kanyomozi call am a "very dark day for Tooro", for one Instagram post. "Gone too soon. What a loss!!!!"

Meanwhile, pop star-turned-politician Bobi Wine, say make King Oyo "soul to rest in eternal peace".