UK ban support for Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC)

Wia dis foto come from, Rouzbeh Fouladi/NurPhoto via Getty Images
UK Home Secretary, Shabana Mahmood announce say Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) go dey officially recognised as threat to national security.
Mahmood go use new govment powers to ban support for di group, wey dey linked to death threats, attacks and intimidation for UK.
For inside one written statement she send to Parliament, she tok how support for IRGC, from if pesin tok good things about dem, express positive opinion about dem, or help dem, go now offence wey dey punishable by up to 14 years in prison.
UK also proscribe two oda groups, di Islamic Movement of Companions of di Right (IMCR), and di volunteer corps of Russia GRU (foreign military intelligence agency).
Dem go give police and police and intelligence agencies new power to tackle espionage, foreign interference, sabotage and physical attacks from these groups.
Dem believe say Iran IRGC direct seven attacks for UK wey het connection wit Jewish and Israeli communities.
One of di attacks na di antisemitic fire attack wey happun on four Hatzola ambulances for Golders Green on March 23, wey IMCR publicly claim responsibility for.
Di prime minister don promise to fast-track di National Security (State Threats) Act for April dis year, and dem fit lay draft regulations for proscription now bifor parliament.
As e dey announce di new powers, Sir Keir Starmer say: "We no go ever let Britain be playground for states wey wan spread fear, division and violence on our streets.
"We don already take tough action against di Iranian regime and dos wey dey linked am, and against Russian operatives and networks wey dey target our kontri.
"These new powers go make am easier to prosecute and lock up anyone wey dey carry out dia dirty work here for Britain."
If Parliament approve am later dis week, pipo wey dey commit these acts of sabotage wey include arson on behalf of these groups fit face life imprisonment.
Di change mean say prosecutors no go need to establish foreign power connection for evri case, wey make am easier and more straightforward to build cases.
Home Secretary Shabana Mahmood say: "Iran and Russia dey use proxies and thugs to do dia dirty work on our shores.
"I don rapidly designate three groups so we go track down dos wey dey work for dem and put dem behind bars."
MI5 discover at least 20 suspected plots wey pipo wey support Iran allegedly plan against people for UK within the last one year, and many of the plots fit cause serious injury or death.
IRGC na key part of Iran govment operations, wey especially dey target Jewish community and Iranians wey dey oppose di Iranian govment.
Di govment argue say di new powers dey necessary becos di state-backed aggression don increase, both for how often e dey happun and how complex e don become.
Dem say threats to pipo lives don rise, and groups wey dey act on behalf of foreign states (proxy groups) dey used more often to carry out attacks and oda harmful activities.
For one written statement, Home Office minister Angela Eagle say: "Di Islamic Revolutionary Guard Corps na central component of di Iranian state security apparatus, wey dey answerable directly to Iran Supreme Leader.
"Work wey IRGC dey do no be only normal military work. Dem dey involved for intelligence gathering, dey use proxy groups and other people to carry out their operations, and dem dey spread their influence in different ways to help achieve the goals and interests of the Iranian govment."









