13 pipo dead and ova 100 aftershocks afta powerful earthquake hit Japan

Wetin we call dis Video,
    • Author, George Wright
  • Published
  • Read am in 6 mins

Japan south-western Kyushu region don get more dan 100 aftershocks since one powerful earthquake wit strike on Tuesday, don cause di death of at least 13 pipo.

Many odas dey for "cardiopulmonary arrest" - one term dem dey often use for preliminary reports for Japan bifor dem officially confam say pesin don die.

Inside di very hot weather, rescue teams dey dig through di rubble for one paper factory and one shopping mall for Kumamoto prefecture. Dem dey find survivors wey dey trapped under di buildings.

Di mall bin suffer one explosion within di same hour afta di earthquake happun.

Japanese Prime Minister Sanae Takaichi warn say na "truly a race against time" to rescue dos wey dey trapped.

As she dey give update about di situation dis morning, Prime Minister Sanae Takaichi express her condolences to di families of di pipo wey die and tank emergency services for dia continued efforts.

Di Japan Meteorological Agency (JMA) don urge residents to dey alert for di possibility of strong aftershocks, public broadcaster NHK report.

"For di next week or so, especially di next two to three days, we go like make pipo watch out for potential earthquakes, wit maximum seismic intensity of 7," one JMA official tok.

Tuesday's quake hit the Kumamoto prefecture on Kyushu island at 16:27 local time (07:27 GMT).

One of the worst-hit buildings was the Aeon Mall in Kashima, where a portion of the second floor collapsed.

Thousands dey for evacuation centres and many of dem dey without power.

Rescue operations dey happun for both di Aeon shopping mall wey collapse and Nippon Paper factory for Yatsushiro.

"Although more dan 20 hours don pass since di earthquake, some pipo still dey wey need help," Takaichi tok. "Dis one truly na race against time."

Residents for Japan Kumamoto prefecture wake up on Wednesday to collapsed buildings and debris

Wia dis foto come from, Getty Images

Takaichi add say dem don deploy 4,600 personnel for di rescue operations.

About 2,000 of dem na from di police force, while about 1,000 na from di fire service.

Around 450 evacuation centres dey open currently, and about 7,700 pipo don evacuate, Takaichi tok.

She add say dem dey take steps to provide di evacuation centres wit food, water, air conditioning and power generators.

"As di evacuation period dey prolong, e absolutely important to make sure say conditions for di evacuation centres remain good," she tok.

Authorities don warn say temperature fit reach 35C for Kumamoto today.

Japan dey try comeback from dia latest major earthquake wey hit di kontri.

Nineteen pipo dey miss for Aeon shopping centre and paper factory afta di 6.8 magnitude earthquake hit Kyushu island, one official tok.

Di earthquake also cause power cuts, e damage roads, collapse one castle wall and destroy footbridge.

Tori still dey come out of Japan but dis na wetin we sabi so far.

Wen and wia for Japan wey di earthquake happun?

Di earthquake hit di Kumamoto prefecture on Kyushu island around 16:27 local time (07:27 GMT) on Tuesday, as dem tell about 300,000 pipo to comot go evacuation shelters.

Kumamoto - wia di Aeon Mall wey collapse dey - na city on di Kyushu island of Japan.

Di southern island of Kyushu na di third-largest of di four main islands for Japan, and di second most populous.

Di Kumamoto prefecture no be stranger to earthquakes.

Total of 278 pipo bin die for 2016 sake of powerful earthquakes for Kumamoto and neighbouring Oita prefectures, according to Japan public broadcaster NHK.

Map of Kyushu, Japan,wey dey show di reported intensity of di earthquake as e dey shake. Di shading dey show from weak (very light pink) to strong (dark red), wit di strongest shaking wey concentrate around di marked epicentre for central Kyushu near Kumamoto.
Wetin we call dis foto, Map wey dey show di epicentre of di earthquake for Kumamoto prefecture on Kyushu island

Wetin happun for di shopping centre?

Pipo still dey trapped inside di Aeon Mall for Kumamoto prefecture, na wetin fire service tok.

Dem neva fit account for 10 pipo wey dey for di shopping centre, one official for di Disaster Management Division of Kumamoto prefecture tell di BBC.

Dem don rescue four pipo from di mall and their lives "no dey in danger", di official add.

Japan public broadcaster NHK earlier bin report say police say di contact of 20 to 30 employees don loss.

One witness report say e see explosion and smoke for di shopping mall afta di earthquake happun.

Di witness bin see di second floor of di building collapse, wit some shoppers wey demcarry go hospital.

Japan fire and disaster management agency later confam say di second floor of di "commercial facility" collapsed, wit many pipo wey dey trapped inside.

You go see wall wey dey damaged on di side of Aeon Mall Kumamoto. Dem write di words Aeon Mall wit bright pink letters.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Kumamoto - wia di collapsed Aeon Mall dey located - na city for di Kyushu island of Japan

Which oda place dey affected?

For anoda place for Kumamoto prefecture, di disaster management official tell di BBC say "dem see two pipo wit "cardiac arrest" for di paper factory and nine pipo still dey miss for di plant.

One chimney reportedly collapse for di Nippon Paper Yatsushiro Plant, according to police, wey NHK bin make reference to.

One aerial photograph of di site wey Reuters news agency get appear to show broken and collapsed chimney.

Aerial view wey show di collapsed chimney for Nippon Paper Industries Yatsushiro Mill afta di earthquake.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Dem beliv say pipo dey missing afta di chimney bin collapse for di Nippon Paper Industries Yatsushiro Plant

Tremors bin also cause historic walls for di 17th-century Kumamoto castle to tumble.

No be di first time di castle don succumb to earthquake. Wen one 7.3 magnitude quake bin hit di region for 2016, part of di 400-year-old castle bin also dey damaged as turrets and curved walls bin collapse.

Aerial view wey show di collapsed part of Kumamoto Castle's stone wall.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Tremors damage walls for di 17th-century Kumamoto castle

One footbridge bin also collapse for di Kumamoto region.

E neva dey clear if anybody wound, or wen di collapse bin happun. E be like say Traffic still dey move for di bridge wey dey run parallel to am.

More dan 40,000 households no get light, according to one update on Kyushu Electric website. Some roads damage.

Na more dan 60 aftershocks ranging magnitude from 1 to 4, Japan Meteorological Agency tok.

Dem bin issue one tsunami warning immediately afta di earthquake, ​but demmbin lift am within two hours.