Wetin dem ban from 2026 World Cup stadiums?

Wia dis foto come from, Getty Images
Fans no go dey allowed to carry reusable water bottles enta inside World Cup stadiums, Fifa tok for dia late policy change.
Di official stadium code of conduct previously tok say 'empty, transparent, reusable plastic bottles, up to one litre capacity, fit come into di stadium."
But just days bifor di tournament kick off on 11 June, bottles – along wit cups, jars and cans – no dey allowed.
Fifa say dis go lower di risk of injury wey fans wey dey throw misiles dey cause.
"Fifa dey committed to protecting di health and safety of all players, referees, fans, volunteers, and staff," football world govning body tok for statement.
Water, fizzy drinks and juices wey dem dey sell for World Cup stadiums dey supplied exclusively by long-time Fifa sponsor Coca-Cola.

Wia dis foto come from, Getty Images
No bottles but free water, no alcohol
Fifa promise fans no go pay more dan each stadium go normally charge at oda events – at least no be for water.
But Free Lions, di Football Supporters' Association's "fans' embassy" service for travelling England fans no gree wit di strange, late change to di code of conduct.
"In all of our discussions, free water availability for stadiums na key one and we dey assured by Fifa say dis go be di case and say fans go get di ability to bring dia own water bottle," official post on social-media platform X.
"Naturally, di immediate thought from supporters na say dis na just di latest money-grab.
"Wat next? Sun cream dey banned and fans go dey forced to buy am for stadiums?"
Although sun cream neva yet make am on to Fifa banned list, any fans wey dey hope to bring flask of tea for half-time – perhaps iced tea sake of di predicted temperatures of up to 40C – go dey disappointed.
As well as bottles, di code of conduct specifically forbid "thermoses and flasks of any kain… as well as any glass objects or any oda breakable material or especially hard packages or hard thermal boxes".
Meanwhile, di only alcohol allow, "unless purchased and consumed within designated areas of di stadium", go be di one within hand sanitiser.
And no more dan 100ml of any liquid – including sanitiser and sun cream – go dey permitted on entry, apart from up to one litre of baby milk or formula wit sterilised water.

Wia dis foto come from, Getty Images
Bulletproof vests

Wia dis foto come from, Getty Images
Oda dan dat, food or liquid (up to half a litre) fit come into di stadiums only "if presented wit medical certificate in English, French or Spanish and for di presence of di pesin wey e dey intended".
But food and drink no only dey banned from World Cup 2026 stadiums.
Also barred from entry, or ejected from stadiums, go be spectators wey dey "use clothing or oda items to hide dia face."
"Oda dan face masks for health or medical purposes, or national, cultural and religious headwear".
Fans no go dey allowed wear "body-protection gear or corsets" (witout medical prescription), "including bulletproof vests and items used for martial arts or extreme sports".
But wearing too little fit also see fans dey excluded. Anyone wey dey act "for offensive or obscene manner by streaking, flashing, removing items of clothing or odawise for state of undress or wey dey show intimate body parts" go dey thrown out.
"For di avoidance of doubt, body tattoos and body paint no constitute clothing," di code of conduct add.
Vuvuzelas, flags, ballons and whistle

Wia dis foto come from, Getty Images
Spectators wey "relieve demsef for any place oda designated toilet" go dey similarly dealt wit.
Dose wey dem go catch throwing tins around, covering CCTV cameras or using flags "oda dan festive and friendly manner", go dey dealt wit.
Flags demsef must dey smaller dan 2m by 1.5m. And any flags, banners, fliers or even clothing wey dey political, offensive or discriminatory "against kontri, private pesin or group on account of race, skin colour, ethnicity, national or social origin, gender identity and expression, disability, language, religion, political opinion or any oda opinion, birth, wealth or any oda status, sexual orientation or on any oda grounds" go dey banned.
Di same rules apply to chants, "foul or abusive language or obscene gestures".
Vuvuzelas, whistles and air horns go dey prohibited as devices wey dey produce "excessively loud sounds".
Oda musical instruments fit dey allowed, howeva, so long as playing dem no go "interfere wit... di enjoyment of oda ticket holders".
Di code of conduct also ban di use of drones, laser pointers, tripods and selfie sticks for stadiums.
Oda strictly prohibited items include inflatables, such as balloons or beachballs - although, "deflated footballs purchased on game day for Fifa venue go dey permitted".










