Wetin we know about di Children Day stampede wia dem teargas students for Edo State

Man waving as e wear white

Wia dis foto come from, Edo State Govment

Published
Read am in 3 mins

Edo State govment don react to di incident wey happun on Children Day wia dem security use tear gas.

Di incident happun for Samuel Ogbemudia stadium for Edo wen children bin gada to celebrate di 2026 Children Day.

Different videos bin dey go round for social media wey show wia crowd of children dey try gain entrance into di stadium.

But e happun say some security comot teargas to disperse di crowd. For some of di videos for social media, children bin try run for safety as di teargas dey affect dia eyes, while some fall.

Di matter don cause serious tok-tok for social media as many dey ask why security use teargas for wia children dey.

Meanwhile, di state govment through di Chief Press Secretary to Govnor Monday Okpebholo say no be wetin dey go round for social media be di real tori.

E say some bad belle pipo dey try change di narrative of wetin happun for di stadium, and di state govment dey reject am.

Di govment say wetin make di security spray tear gas for wia di children dey na to calm di situation, but dem don gbab di security wey do di tin.

Meanwhile, several pipo dey question di safety of di children wey di security spray tear gas and dose wey injure for di incident.

Di govment confam say di stadium dey filled to full capacity during di Children Day activities as thousands of children gada to participate.

"All di entrances to di facility dey open for children to gain access to to di stadium. Di turn out na somtin wey neva happun bifor."

Di govment claim say tin turn bad wen some children cause stampede to happun.

Na dia di bouncers wey dey around di gate of di stadium kon use 'tear gas' to scata di crowd.

"Some children resort to unruly behaviour for one gate, one incident lead to some kain stampede wey make bouncers to use tear gas to disperse dem.

"In di cause of di pandemonium wey happun, few students sustain injuries," di govment tok.

Di govment confam say true true some of di students injure during di incident.

'Bouncer in police custody'

Di govment say na di deputy Govnor Dennis Idahosa bin help some of di children wit first aids and also carry some go di state hospital.

"Di Edo State govment don alreadi authorise investigations into di incident while di bouncer wey dey involved presently dey ansa question from di Police to find out di immediate or remote cause of di incident."

Di govment add say make pipo no panic and make dem no spread informate wey no correct about di incident.