Five times wey Boko Haram kpai senior Nigerian military personnel for 2026

Wia dis foto come from, Nigerian Armed Forces
Di Nigerian Army confam death of senior commander wey bin lead Munguno camp for Borno State, northeastern Nigeria, wey kpai for Boko Haram attack.
For dia statement, di tok-tok pesin for di Operation Hadin Kai, Colonel Sani Uba, say di commander wey dem no give im name, bin kpai afta di vehicle wey e dey inside bin hit explosive device wey di terrorists bin plant.
Di military also express dia condolences on di deaths of di senior officer and di sojas wey die wit am at dat time.
Di death of di senior military officer dey come less dan one week afta reports say Boko Haram terrorists kill Brigade Commander of di 29 Task Force Brigade for Benisheikh, Kaga Local Govment Area of Borno State.
Dem kill Brigadier General Oseni Braimah for attack wey happun for midnight of Thursday 9 April.
Dis no be di first time Boko Haram terrorists dey attack senior military officers wey dey fight di group for Borno State.
By tracking reports from local newspapers and military statements, we look di commanders of five military camps wey Boko Haram attacks kill for 2026.
Leader of di Damasak camp - January
For January of dis year, Iswap insurgents bin attack di Damasak military base for Mobbar Local Govment Area, wia dem kill di camp senior military officer, wey be Major.
At di time of di attack, local media Vanguard newspaper report say di senior officer dey lead di camp om foot patrol wit about 30 of im sojas wen dem come across di jaguda pipo, wey plant explosives for dem.
Reports at di time say di attack force di sojas to abandon di camps, although some later return.
Commander of di Kukawa camp - March
Na for early March wen Boko Haram terrorists launch attack on di Kukawa military camp for Borno State.
At di time of di attack, local media Daily Trust newspaper report say di attackers launch di assault for di middle of di night, killing di camp commander, Lieutenant Colonel Umar Faruq.
Reports tok say during di attack, di Boko Haram militants burn several military vehicles and steal ammunition.
"I no fit confam di number of sojas wey die, but di camp commander dey among dem," security source tell di newspaper at di time.
Konduga - March
March na di month wen Boko Haram terrorists, particularly di Iswap faction, begin dia attacks on military camps for Borno.
For one video wey dem release for Amaq news agency, e show how dem carry out attacks and burn military vehicles for various camps for Borno State.
Among di camps wey dem attack na dat of 2nd Battalion for Konduga, wit di killing of dia commander, Lieutenant Colonel S.I. Iliyasu, as reported by local media Daily Trust newspaper at dat time.
Mayanti - March
Apart from Konduga, anoda military camp attack by Boko Haram terrorists happun for Mayanti camp for Bama Local Govment Area.
During di attack, report say di militants kill di camp leader, Major U.I Mairiga.
For video wey Iswap release, dem claim say dem carry out di attack overnight, and kpai large number of sojas.
Benisheikh - April
Earlier dis April, Boko Haram terrorists attack di Benisheikh military installation for Borno State, northeastern Nigerian.
Di Brigade Commander of di 29 Task Force Brigade wey dey operate under Operation Hadin Kai, Brigadier General Oseni Braimah, die during di attack on Thursday 9 April for Kaga Local Govment Area of Borno State.
For statement wey di Nigerian Defence Headquarters release, dem say di sojas successfully stop di attack afta responding wit determination, professionalism, and superior firepower.
Nigeria President Bola Tinubu bin send condolence message to di families of di military personnel wey die for di attack.
Monguno - April
Also for recent days, di leader of di military camp for Munguno lose im life afta im vehicle run ova explosive device following Boko Haram attack.
Di military confam di death of di senior military officer for statement wey dem release.
Di Army say di troops bin maintain control of di location wen dem come under isolated attack for Charlie 13 for Monguno, Borno State.
"Regrettably, di Commanding Officer, while e courageously go di troops location to personally assess di situation, e encounter one Improvised Explosive Device (IED) wey seriously affect im vehicle, leading to im death alongside six oda gallant personnel."
Tinubu meet wit senior security chiefs
President Bola Tinubu bin hold secret meeting wit di kontri top security chiefs for im residence.
Dose wey dey present for di meeting include Chief of Defence Staff, General Olufemi Oluyede; Chief of Army Staff, Lt. Gen. Waidi Shaibu; Chief of Naval Staff, Vice Admiral Idi Abbas; Chief of Air Staff, Air Marshal Sunday Anele; Director-General of di Department of State Services, Oluwatosin Ajayi; Director-General of di National Intelligence Agency, Ambassador Mohammed Mohammed; and Inspector-General of Police, Tunji Disu.
Reports indicate say di meeting dey linked to di kontri bad security situation and discussions on new measures.
Di meeting come shortly afta private meeting between di National Security Adviser and im French counterpart, according to local newspapers.










