Bonnie Tyler, di gravel-voiced star wey capture evribodi heart don die

Wia dis foto come from, Getty Images
Bonnie Tyler dey known to millions as di gravel-voiced singer behind '80s hit Total Eclipse of the Heart.
Dem born di star, wey die at di age of 75 as Gaynor Hopkins for one Neath council house wia she grow up wit love for music bifor talent scout Roger Bell discova her for Swansea club.
For May, dem put her for induced coma afta she get emergency intestinal surgery for Portugal, and last month, her tok-tok pesin say she don come out of di coma but she still dey "veri unwell and for intensive care".
Afta she bicom popular, pipo nickname her "di female Rod Stewart" for her husky vocals, and she go on to get career wey span 50 years.
But evritin bin start from young age wen she go carry records for carrier bags go her aunt house go play wit her cousins.

Wia dis foto come from, Getty Images
Young Gaynor bin love rock music and wan dey for inside band.
Afta seven years of gigging for rugby and to dey work for men clubs, di chance to record bin finally come.
She say she bin get "no big ideas" about making records until Roger Bell come her way.
"E know say Ronnie Scott and Steve Wolf bin dey find girl wey go record dia songs so e tell dem about me," she tok.
"I go London and one of di first demos I record bin lost for France and den I dey on Top Of The Pops."
Lost in France, wey she release for 1976, na her first single to make di UK charts, wey make am to number nine.
But her love of rock no eva leave her and she wan do "raunchier stuff".
Bonnie bin go on to sign wit RCA, wey get Elvis Presley on dia books.
At di time, she bin dey work under di name Sherene Davies but di label suggest say she change Sherene as e "sound like belly dancer".

Wia dis foto come from, Getty Images
She release Total Eclipse of the Heart five years afta Lost in France. E change her life.
"Di first time I hear am na wen [songwriter] Jim Steinman just play am on di piano for New York," she tok.
"E sing di song all di way through and I be like, 'Oh my god, dis song dey amazing. I no believe say Jim dey give am to me'.
"Wen I record di song, I tink say nobodi go play am becos e dey veri long.
"Di original version na eight minutes long."
But one four-minute radio version bin take di world by storm, wit di ballad wey spend two weeks as UK number one, and four weeks for US.
Bonnie na di first - and only - Welsh artist to get number one for US.
She bin go on to get string of oda hits, wey include Holding out for a Hero, It's A Heartache, Together, and If You Were A Woman [And I Was A Man].

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem nominate di star for best female vocal Grammy three times - for di Total Eclipse of di Heart single, album Faster Than The Speed Of Night plus di single Here She Comes.
For 2013 she represent UK for di Eurovision Song Contest.
Dem name Bonnie for di Queen last Birthday Honours list for 2022 and Prince William award her MBE for her services to music for 2023.
"I grow up for council house. I no eva tink say I go get MBE," she tok for 2023.
Dat year she publish one autobiography, called Straight from the Heart.
"I be veri shy little girl so how on Earth I reach how I dey now na bit of a journey and I take you on dat journey," she tok.
"I no tink say dis go happun to a Gaynor from Skewen, you know."
Dis year, di song wey make her star enta billion streams on Spotify.
On YouTube, dem watch di video more dan 1.3 billion times.
Afta 43 years of singing di song, she say e no tire her.
"I love am," she tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
"My mama bring me up to believe in mysef," she tell BBC last year.
"I bin dey veri shy as little girl growing up for school, but I don overcome am, becos I love to dey sing."
Bonnie love for di industry bin dey veri clear for dat interview, and she bin just release new single Yes I Can, one song wey dey about finding inner strength and believing in yoursef.
Reports suggest say Bonnie and her husband, Robert Sullivan, get 22 homes worldwide, though dem dey split dia time between Portugal and dia home for Mumbles, Swansea.

Wia dis foto come from, Getty Images
Despite coming from big, musical family, Tyler and Sullivan no get children.
She bin tell BBC Sounds one time say: "I absolutely adore children.
"You know wen most pipo enta plane begin avoid children like disease, no be me. I go be like, 'I fit sit here'?
"I bin get miscarriage wen I be 40, I no quickly attend to am, you know? I wish I bin start earlier, but my career take ova and na always, 'next year, next year'.
"And den next year no come until I be 39."
Afta Tyler miscarry, she throw hersef into work.
"We try for anoda couple of years, but... we dey fine, we dey happy."
She conquer di music world, and love Europe - but Bonnie Tyler go always dey remembered as di Welsh star wey no wait for hero, but bicom one to millions hersef.










